Nick Imudia: Who be di former Konga boss wey die?

Di Lagos State police command don confirm di death of Nick Imudia, one businessman and entrepreneur wey don be oga for some top-top companies for Nigeria.

Imudia dey most popular as di former oga kpatakpata for Konga Group we get one of di most popular online shopping platforms for Nigeria.

Benjamin Hundeyin, di tok tok pesin for di Nigeria Police, Lagos State, confirm to BBC Pidgin through a short phone call on Thursday say, “e dey confirmed, we get report of di incident.”

Circumstances surrounding im death no dey clear yet as family never come out to confirm and police too no provide details.

But local media dey report say e die inside one accident for im house for Lekki on Tuesday, June 25.

Who be Nick Imudia?

For im LinkedIn account, Nick Imudia describe imsef as “a results-oriented professional wey get passion for driving business growth”.

Imudia get B.Eng for Industrial Management, M.En for Oil and Gas Technology Management, and MBA for International Business Management.

E work for Nokia for more dan 17 years, and rise to di position of GM/MD for West and Central Africa.

Imudia don also work as Managing Director, West & Central Africa for TCL/Alcatel, one mobile phone manufacturer wey base for Hong Kong. And im current work before im death na as di CEO for d.light, wey be international energy transformation company.

Nick wit im brothers Martins and Anthony Imudia, setup di Imudia Foundation in honour of im Papa wey die in 2011. Di foundation dey help poor pipo from im community in Ika South, Delta State in areas of health and education.

Tori be say oga Nick Imudia get one daughter from im previous marriage wey later end for divorce.

Although circumstances around im death never dey made public by authorities, Nick Imudia death don bring up di issue of depression especially among wealthy and influential pipo. Di topic dey among di top trends on X for Nigeria dis Thursday morning.

How to look for help wen you dey down

Everi 40 seconds someone, somewhere for di world go take im own life and about 800,000 pipo die because of suicide everi year according to di World Health Organization (WHO).

Dis number dey very big – yet dis na topic wey WHO say pipo no dey too dey tok about and e dey affect children, parents, partners, friends or colleagues of di victims.

Suicide dey often linked to di feeling of isolation and you fit help comot suicidal thoughts for your mind by reaching out to somebodi.

E no get any right or wrong way to tok about suicidal feelings – Emma Carrington, wey be tok-tok pesin for Rethink UK, tell BBC for 2019.

“First of all we need to recognisee say dis na difficult conversation. No be everi day kind of tok-tok, dis one dey different, so you go feel nervous and dis no be bad tin.”

“Wetin dey important na to start di tok” and if pesin carry dat kind tok come your side. make you listen and no judge di pesin.”

One US study wey dem publish in 2018 tok say, for every pesin wey kill imself, di news or action fit affect up to 135 oda pipo.

Source