Osun state governorship election result Live updates

Inec official hold ballot paper

BBC

Di pipo of Osun State for southwest Nigeria dey decide who go lead dem for di next four years on 16 July, 2022.

Di election go see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991.

Na fifteen candidates dey di race to become di next govnor of di South Western state.

Na Nigeria Independent National Electoral Commission, INEC go announce di winner of di election.

According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.

Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).

Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.

Move around di map to see breakdown of how di candidates dey perform

See profile of di top candidates (Click di drop-down near di candidate name to read more about am)

Continue to dey refresh di page to get di results as Inec begin dey drop am.