
Shoprite retail company, wey be Africa number one supermarket chain, on Monday announce say dem dey consider to end dia business for Nigeria.
Di South Africa company, wey open dia first store for Lagos in 2005, say dem dey find buyer for dia business inside di West African kontri.
Shoprite na di latest South African retailer to consider leaving Nigeria – clothing firm Mr Price announced been announce dia exit in June, and Woolworths wey be anoda retail giant bin waka comot in 2014.
- South Africa Shoprite suffer attacks for Nigeria
- Shoprite Black Friday, oda places you fit find awoof deals today
Shoprite decision dey come at a time wen Nigeria economy dey struggling in di middle of di coronavirus pandemic
Dis go come as shock and surprise to many Nigerian shoppers and customers wey see Shoprite as one of di biggest supermarket for di kontri, especially as sign no show say dem dey struggle.
Inside di half-year company report wey dem release on 3 August, Shoprite say investors don dey offer to buy dia business so tey di board don reason am to sell.
“Di board don decide to formally consider to sell all, or majority shares on Retail Supermarkets Nigeria Limited, wey be subsidiary of Shoprite International Limited,” di report bin show.
Wit 25 shops across Nigeria, Shoprite dey employ at least 2000 pipo wey be Nigerians alone.
One public relations consultant to Shoprite for Nigeria, Mr. Ini Achibong tell di BBC say e don tey wey di company don dey find investors wey go buy and say nothing don change for di Nigeria operation for now.
Shoprite say di lockdown restrictions because of coronavirus don affect dia operations in 14 African kontris, wit sales reducing by 1.4% for dis markets markets.
Shoprite yan for dia latest financial statement say di Xenophobic attacks wey happun for Nigeria for September, 2019 bin affect dem wella.
- Why Kodak dey port from photography and crypto currency to drug business
- Wetin MTN Nigeria NSE listing fit cause

How Nigerians dey react to Shoprite leaving Nigeria
Once again, the planned departure of Shoprite from Nigeria emphasises why as Nigerians, we must buy and consume Nigerian products if we must grow our economy and strengthen the Naira. #BuyNaijaToGrowTheNaira
— Ben Murray-Bruce (@benmurraybruce) August 3, 2020
Shoprite plans to discontinue operations in Nigeria.
Well this sounds good for locals but a negative scorecard that will discourage foreign investments in this country. pic.twitter.com/anTePjN5aa
— AyeMojubar 🇨🇳🇳🇬 (@ayemojubar) August 3, 2020
Anticipatory LOL @ how some Nigerians are going to politicize this news of Shoprite exploring a sale of Nigerian Biz. All sorts of foolish hot takes in the coming hours😂
PS: Gloaters about Mr Price leaving Nigeria will not mention they’ve also recently exited Australia & Poland https://t.co/HNhQXx5fSG
— tolu ogunlesi (@toluogunlesi) August 3, 2020
Looks like the Shoprite Sale deal is much much closer to conclusion than assumed 😀 But wait for official announcements thanks. A group of Nigerian investors are taking it over to build a world-class Nigerian retail brand. I wish them the very best! 🕺🏾
— tolu ogunlesi (@toluogunlesi) August 3, 2020
Shoprite is a direct foreign investment in Nigeria. The economic impact is huge. Their leaving Nigeria will definitely affect our economy. For instance, over 80% of their workforce are Nigerians.
— Women_Advocate🧕🧕🧕 (@hauwa_farouk) August 3, 2020
So Shoprite is pulling out of Nigeria after years….Lol
I will be waiting for one Ayourb or Ajuri to lecture me on how this won’t affect Nigeria economy, and how Buhari war against corruption led to it. They might come up with “corruption is going in shoprite”. Predictable.— Premier (@SodiqTade) August 3, 2020
SHOPRITE leaving Nigeria! Ahh 🙆🏽♂️ what will become of Ilorin now?
Our only tourist center.
Where are going to celebrate Ramadan now 😭 pic.twitter.com/om0tfkz6s8— Tamuno-Opubo George 📷 (@GodsgreatG) August 3, 2020