BBNaija 2020 Eviction: Nengi, Praise, Dorathy, Ka3na and oda housemates wey fit comot from Big Brother show dis Sunday

Some Big Brother Naija season 5 lockdown edition housemates fit comot from di house on Sunday , August 2.

Dis week, 18 out of di 20 housemates dey up for eviction afta Biggie introduce new twist to di game.

Voting don close for di housemates wey dey up for possible eviction dis week inside di Big Brother Naija Lockdown house.

Na only di Head of house Lucy and her deputy Prince wey get immunity for di house.

Di odas wey dey up for eviction na:

  • Ozoemena Chukwu AKA Ozo
  • Victoria Adeyele AKA Vee
  • Boluwatife Aderogba AKA Lilo
  • Timmy Sinclair AKA Trikytee
  • Terseer Kiddwaya
  • Dorathy Bachor
  • Praise Nelson
  • Florence Wathoni Anyansi
  • Tochukwu Okechukwu AKA Tochi
  • Kate Jones AKA Ka3na
  • Eric Akhigbe
  • Ngozi Nlewedim AKA Erica
  • Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
  • Aisha Umaru AKA Kaisha
  • Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
  • Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
  • Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
  • Rebecca Hampson AKA Nengi

Depending on wetin be di outcome of di votes na some of di housemates wey get di least vote go comot from di house.

How di Live Eviction go work dis season?

Every Sunday di housemates go take part for di live eviction.

Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.

Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.

Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.