Who be di ogbonge players for di Olympics football event

players for di Olympics football event

Getty Images

Na few days remain for di 2024 Paris Olympic football event to start. Di football event wey go start on Wednesday go feature men and women games for seven cities across France.

Di men and women finals go shele for Paris for di Parc des Princes.

Even though di Men’s Olympic team na mainly players wey dey under di age of 23, dem still get chance to carry three overaged players.

But di women’s teams no get any age restrictions, anybody wey dey fit go play.

Even though Nigeria men no qualify for di 2024 Olympics, Nigeria Women national team di Super Falcons qualify.

Dem go begin dia campaign on Thursday against Brazil. See some of di ogbonge players to look out for during di Olympics football event.

Chiamaka Nnadozie

Chiamaka Nnadozie

Getty Images
Chiamaka Nnadozie

Chiamaka Nnadozie na di current number one goalkeeper for Nigeria Women’s national team. Na striker wey switch to goalkeeper for 2012.

Nigerians dey expect say she go shine for dis Olympics and na her first Olympic games be dis.

Chiamaka start to represent Nigeria for age grade international tournaments like di Under 17 and 20 Women’s World Cup.

She don also play for di Africa Women’s Cup of Nations for 2019.

She play for Rivers Angels Football Club from 2016 to 2020 wia she help di club win di 2019 Nigeria Women’s Premier League title bifor she join Paris Football Club from 2020 till date.

She enta di Super Falcons wen she dey 19 years and since dat time she don develop hersef to world class goalkeeper.

Chiamaka become di youngest goalkeeper wey no concede any goal for di 2019 World Cup for France.

Asisat Oshoala

Asisat Oshoala

Getty Images
Asisat Oshoala

Asisat Oshoala na di number one woman for African football. She don win di award six times for 2014, 2016, 2017, 2019, 2022, 2023.

Na ogbonge striker wey don win plenti honours both for club and kontri, and football fans hope be say she go use her skill and experience carry i tam go far for di Olympics.

She bin play for di 2015, 2019 and 2023 Fifa Women’s World Cups.

She also win di 2014, 2016 and 2018 Women’s Africa Cup of Nations and semi finalist in 2012 and 2022.

Asisat represent Nigeria for U20 levels including di Fifa U20 Women’s World Cups for 2012 and 2014. She win silver for di 2014 edition.

Asisat club career dey ring bell, sake of say she don play for most of di big clubs for Europe.

From FC Robo Queens for 2013 to Rivers Angels wey she join from same 2013 to 2015.

Since den she don play for England wit Liverpool FC and Arsenal FC, she join Dalian Quanjian for China, bifor she go FC Barcelona for Spain. She stay wit Barcelona for four seasons, 2019 t0 2024. She recently sign for Bay Fc for USA.

Michelle Alozie

Michelle Alozie

Getty Images
Michelle Alozie

Michelle Alozie na Nigerian born to di family of Godwin and Chioma Alozie. Dem born her for United States.

Di 27 year old na one of Nigeria favourites – fans like her well well especially for her defensive play.

Her first match for Nigeria na international friendly wen Nigeria play against Jamaica for 2021for Houston.

Michelle graduate from Yale University for 2019 wit a Bachelor’s degree in Molecular, Cellular and Developmental Biology.

Apart from football Michelle dey work part-time as a cancer research technician for di Texas Children’s Hospital for Houston.

She play for Nigeria for di 2023 Fifa Women’s World Cup and di 2022 Women’s Africa Cup of Nations.

Between 2020 and 2021 she bin play for BIIK Kazygurt, KAZ Houston Dash, USA 2021.

For her college career she play for Yale Bulldogs, USA between 2015 and 2018. She also play for Tennessee Volunteers, USA for 2019. She bin win di 2012 league title wit Legends FC

Oda ogbonge stars to watch out for

Some big names of footballers wey don go Olympics include, Lionel Messi, Alex Morgan, Ronaldinho, John Mikel Obi, and Ellen White and many more.

Who be oda ogbonge stars wey go play football for dis Olympics?

Martha (Brazil)

Martha

Getty Images
Marta score 118 goals in 183 games for Brazil

Martha na di all-time leading goalscorer for Brazil and she go end her international football career afta she captain her kontri for Paris.

Martha wey dey 38-years dey plan to retire from national team duty, but afta she win silver medal for Athens 2004 and Beijing 2008, she wan play one last shot if she go win gold.

For Tokyo, Martha bin make history as she become di first footballer to score for five straight Olympic Games.

She bin score five goals for 13 NWSL games for Orlando Pride last season and Brazil manager Arthur Elias say “she dey play veri well, she deserved to dey for dis list” for Paris 2024.

Aitana Bonmati (Spain)

Aitana Bonmati

Getty Images
Aitana Bonmati bin win di Women’s Ballon d’Or for di first time in 2023

Spain women’s team neva compete for di Olympics bifor but dem dey go Paris as one of di favourites.

Di reigning world champions don lose only two times for 14 matches since dem beat England for di World Cup final last August.

Plenti beta players dey Montse Tome squad , but all eyes go dey on Aitana Bonmati, she be player we pipo sabi say she dey step up for di biggest moments.

Afta she win di Nations League wit Spain and di quadruple wit Barcelona dis season, she go fit add anoda gold medal to her collection at di age of 26?

Julian Alvarez (Argentina)

Julian Alvarez

Getty Images
Julian Alvarez bin score two goals for Argentina for di recent Copa America

Julian Alvarez just dey come back fresh from dia Copa America victory, Argentina na di favourites to win di men’s gold medal for Paris.

Along wit Nicolas Otamendi and Geronimo Rulli, Manchester City forward Julian Alvarez na of Argentina overage players for di squad.

Javier Mascherano dey hope to coach di kontri to dia third gold medal.

Julian Alvarez wey dey 24 years score 11 goals in 36 appearances for Pep Guardiola side last season as dem win dia fourth successive Premier League title.

Alvarez go miss Manchester City pre-season tour for di United States and di Community Shield match against Manchester United, wey go happun di day afta di gold medal match.

Alexandre Lacazette (France)

Alexandre Lacazette

Getty Images
Alexandre Lacazette bin no dey for France Euro 2024 squad

Thierry Henry select Alexandre Lacazette to captain France for dia home Games.

“All of us get di same ambition, to go all di way to win medal,” di 33-year-old tok. “Di fact say we dey play for home go really ginger us.”

Di Lyon forward neva play for im kontri since 2017 but im score 22 goals in 35 games for di Ligue 1 club last season, wey show say im still dey in good form.

Sevilla Loic Bade na anoda overage wey dem nclude for di team, along wit Crystal Palace forward Jean-Philippe Mateta, wey be di only Premier League player for di squad.

Kylian Mbappe, wey bin dey hope to be part of di squad as an overage player, no dey for di squad – as im new club Real Madrid no want any of dia players to play for di Games.

Achraf Hakimi (Morocco)

Achraf Hakimi

Getty Images
Achraf Hakimi help Morocco reach di semi-finals of di 2022 World Cup

Achraf Hakimi na anoda big name player wey go represent im kontri Morocco for di Olympics.

Di 25-year-old go miss Paris St-Germain pre-season preparations as Morocco dey prepare to play di summer Games for di eighth time.

While Hakimi bin miss two penalties for di pre-tournament friendly against French side Villefranche, im go lead di Atlas Lions to di final for Parc des Princes.

Tarik Sektioui’s side qualified for Paris 2024 afta dem win di 2023 Under-23 Africa Cup of Nations.

Source