Di ogbonge stadium Saudi Arabia wan build wey only high-speed lifts and driverless cars go fit access

Saudi Arabia wan build one ogbonge stadium for Neom, north-west of di kontri.

And na only high-speed lifts and vehicles wey no get driver fit get access to di stadium. Di stadium go dey 350 metres above ground level.

Dis na as Saudi Arabia submit plans to build 11 stadiums as part of di kontri bid to host di 2034 World Cup.

Di arena, wey dey part of ‘The Line’ project to diversify di economy of di kingdom away from oil, go dey set to host one quarter-final match.

No kontri dey contest with Saudi Arabia bid to host di 2034 World Cup and dem get until October deadline to submit dia plans.

Out of di 11 new stadiums, eight go dey for di capital Riyadh – including di 92,760 King Salman International Stadium, wey go host di opening match and di final.

Di cities of Jeddah, Al Khobar and Abha go also host matches.

Di 2034 World Cup go be di first time di expanded tournament wey now don be 48-team event go happun for one kontri.

Fifa go confam di hosts of di 2034 World Cup for Fifa congress on 11 December.

Seven cool facts about Qatar 2022 Fifa World Cup

Argentina vs Saudi Arabia highlight: Lionel Messi, Di Maria skill no dey enough to deny Saudi Arabia victory for Qatar 2022 Fifa World Cup

Davido social media post ahead of im performance for Qatar World Cup final ginger fans

How much development dem need to do?

For di case of di Neom stadium, dem go need to build an entire new city.

Dem don pitch di flagship project, The Line, as a car-free city, [no use of motor for dia] and na just 200m (656ft) wide and 170km (106 miles) long – even though na only 2.4km of di project dey expected to don complete by 2030 according to reports.

Di Line go tall pass di Empire State Building and e go almost dey as long as di distance between Bristol and London.

Di bid document claim say di new Neom stadium go dey “run entirely on renewable energy”, mainly from wind and solar sources.

Dem also get plans to build a new international airport for Neom, wey di bid document state say e go get 12 million domestic and international visitors annually by 2034.

Dem go also expand di airports for all di oda host cities, Riyadh dey expected to get 100m passengers evri year by 2034 – an increase of 170% on 2023 – while dem go upgrade Abha airport to increase di passenger capacity from 1.5m to 8m in time for di tournament.

Saudi Arabia dey also plan to extend train lines and bus routes, with di document wey state say “movement around di kontri go dey sharp sharp and efficient”.

Tori be say Qatar bin spend $220bn (£172bn) to host di 2022 World Cup.

Di Saudi bid document no state di overall cost of hosting, but di plans wey dem outline go need hundreds of billions of dollars.

Wen e fit happun

Like di case of di 2022 World Cup in Qatar, a winter tournament fit dey necessary for temperatures to dey cool enough.

Temperatures for Saudi Arabia dey for di mildest between October and April.

During dis months, average daily temperatures for host cities range between 15 and 30 degrees Celsius.

Between May and September, average daily temperatures dey range between 17 and 38C.

Full list of stadiums

Riyadh

King Salman International Stadium – 92,760 capacity

King Fahad Sports City Stadium – 70,200

Prince Mohammed bin Salman Stadium – 46,979

New Murabba Stadium – 46,010

Roshn Stadium – 46,000

Prince Faisal bin Fahad Sports City Stadium – 46,865

South Riyadh Stadium – 47,060

King Saud University Stadium – 46,319

Jeddah

King Abdullah Sports City Stadium – 58,432

Qiddiya Coast Stadium – 46,096

Jeddah Central Development Stadium – 45,794

King Abdullah Economic City Stadium – 45,700

Al Khobar

Aramco Stadium – 46,096

Abha

King Khalid University Stadium – 45,428

Neom

Neom Stadium – 46,010

Sabi pipo tink say Saudi Arabia bin don invest more dan £5bn in sport since 2021, wen di Crown Prince of di kontri bin make sport a key part of im strategy to diversify di economy.

Dem don host plenti major sporting events, including football, Formula 1, golf and boxing, while di Public Investment Fund for di kontri don launch di breakaway LIV Golf series, wey dey take control of four Saudi Pro League clubs and also buy Newcastle United.

However, dem don sama accuse on di Gulf kingdom say dem dey use dia investment in sport and di hosting of high-profile events to improve dia international reputation – a process wey dem dey call ‘sportswashing’.

Dem bin don criticise Saudi Arabia for human rights violations and dem bin don face accusations ova di 2018 murder of journalist Jamal Khashoggi.

Women’s rights abuses, di criminalisation of homosexuality, di restriction of free speech and di war in Yemen follow for di issues dem dey drag Saudi Arabia for.

Di Saudi goment say dia investment in sport dey boost di economy, and e dey also open am up to tourism and inspiring pipo to dey more active.

According to Fifa guidelines, kontris wey dey bid to host di event must commit to respect human rights.

Speaking to BBC Sport for December, Saudi Arabia sports minister Prince Abdulaziz bin Turki Al Faisal say claims of sportswashing against di kontri dey “very shallow”.

“Any kontri get room for improvement, no-bodi dey perfect. We acknowledge say dis events go help us reform to a beta future for everyone,” im tok.

Source