Manchester United continue attempt to overtake Newcastle despite win against Everton

Manchester United vs Everton

Getty Images

Manchester United don sama Everton 2-0 for Old Trafford as dem retain dia third position for di English Premier League table on 8 March.

Dis dey come as di Red Devils dey continue dia fight for a Champions League place.

Erik ten Hag men welcome relegation strugglers Everton to Old Trafford dis afternoon afta dem try beat Brentford for midweek.

Na Scott McTominay net di first goal for Man U for first half, while Anthony Martial score di second goal for second half.

Second half kick-off, Man Utd 1-0 Everton

90+3 mins FULL-TIME

Man Utd 2-0 Everton

A comfortable Manchester United win wey suppose be an emphatic one.

E don strengthen dia place in di top four, six points ahead of fifth-placed Spurs.

Everton gazz sit and watch dia relegation rivals to see how damaging dis loss go be?

90+2 mins

Man Utd 2-0 Everton

Jordan Pickford get down low to push di ball away from Tyrell Malacia. Soon after, im dive to save a shot from di same player.

The Everton keeper has done all he can today.

90 mins

Man Utd 2-0 Everton

Christian Eriksen try to add a cherry on top for Manchester United but afta latching on to a low corner wey dem play to am near di penalty spot, dem block im shot.

89 mins

Man Utd 2-0 Everton

Di Everton body language tell you say dem know dia race dey run here.

Just to keep am 2-0 go be di plan.

87 mins

SUBSTITUTION

Man Utd 2-0 Everton

Seamus Coleman’s difficult afternoon don dey ova.

Nathan Patterson don replace am as im limp a bit.

86 mins

Man Utd 2-0 Everton

Seamus Coleman almost gift Manchester United anoda goal wit some poor control. Im takcle Scott McTominay before Bruno Fernandes fire a shot straight at Jordan Pickford.

85 mins

Man Utd 2-0 Everton

Chance!

Scott McTominay pick out Bruno Fernandes at di back post but e only fit head straight at Jordan Pickford.

84 mins

Man Utd 2-0 Everton

Tom Davies fly in late on Fred. Na foul but Michael Oliver keep im cards inside im wallet. Still neva get a booking for di game.

83 mins

Man Utd 2-0 Everton

If Everton get any hope of getting sometin from dis, dem gazz score very, very soon.

Dem still dey put in di work, but dem no dey hurt di home side.

80 mins SUBSTITUTION

Man Utd 2-0 Everton

Marcus Rashford no go continue. No point to take further risk at 2-0 up, but nobody from Man Utd go wan see di forward out of di pitch for any length of time.

Wout Weghorst don enta as Rashford limp towards di tunnel.

79 mins

Man Utd 2-0 Everton

Seamus Coleman try to make amends for im error wit effort from range wey David de Gea save.

78 mins

Man Utd 2-0 Everton

Dis fit take di shine off.

Marcus Rashford pull sometin as im try to reach di ball wey go out for a goal-kick.

Di game continue as im dey off di field as e go need treatment.

73 mins

Man Utd 2-0 Everton

Dis na Anthony Martial’s first Premier League goal since December.

E love to dey playing Everton. E don dey involved for 12 goals in 16 appearances for Manchester United against Everton for all competitions (8 goals, 4 assists), im most goal involvements against any opponent for di Red Devils.

71 mins GOAL – Man Utd 2-0 Everton

Anthony Martial

Game over, surely!

70 mins

SUBSTITUTION

Man Utd 1-0 Everton

Ellis Simms komot for Neal Maupay to enta.

66 mins

Man Utd 1-0 Everton

Everton know dia best route back into dis by giving di home side a physical challenge for di back.

A couple of corners threaten trouble but United dey able to get di second away. Dem get am away well sef as e set up a break…

65 mins

Man Utd 1-0 Everton

James Tarkowski na forward for Everton and im dey cause kasala.

Im header down allow Ellis Simms to fire a shot wey dey blocked before Alex Iwobi follow up for one effort wey deflect behind.

64 mins

Man Utd 1-0 Everton

Wetin dey happun?!

Scott McTominay give Seamus Coleman a little shunt with im knee afta di Everton defender don drop on di ground. Some players gada to dey shove before di referee come ova to sort am out.

Dem no take any further action.

62 mins

Man Utd 1-0 Everton

Jordan Pickford dey forced from im goal to gada di ball and stop Marcus Rashford latching on to anoda chipped ball forward from Bruno Fernandes.

61 mins

Man Utd 1-0 Everton

So, no Abdoulaye Doucoure for Everton today. Now no Idrissa Gueye or Amadou Onana sef.

SUBSTITUTIONS

Man Utd 1-0 Everton

More Everton changes. Sean Dyche remodel im midfield, as Tom Davies and ex-United man James Garner come in for Idrissa Gueye and Amadou Onana.

Di home side also change players as Anthony replace Antony Martial.

56 mins

Man Utd 1-0 Everton

Set-pieces remain di most consistent source of danger from Everton.

Antony commit foul near im own box and e allow di visitors to whip in a cross wey James Tarkowski head ova.

55 mins

Man Utd 1-0 Everton

Everton finally get hold of di ball for one meaningful area. Alex Iwobi carri am towards di United box and find Ellis Simms, but dem block im shot from range.

54 mins

Man Utd 1-0 Everton

Manchester United guilty of too many touch.

Marcus Rashford fail to get im shot away near di edge of di box, and im invite a tackle. Everton no fit fully clear and di England forward almost get a second bite of di cherry until dem flag am offside.

52 mins

Man Utd 1-0 Everton

No be say Manchester United dey just dey get majority of possession, dem also dey tougher for di tackle at di moment to win am back.

Everton dey really struggle for any kind of foothold.

50 mins

Man Utd 1-0 Everton

Ellis Simms dey fight battle battle for Everton. Dis na tough job for di kid.

49 mins

Man Utd 1-0 Everton

David de Gea neva make a save. Ellis Simms suppose force am to make a save.

47 mins

Man Utd 1-0 Everton

Manchester United drive drive one low cross into di box but Everton hack am away.

We don come back!

Everton don change players. Left-back Vitalii Mykolenko enta for Ben Godfrey, wey bin get tough time for first half.

First half kick-off, Man Utd 0-0 Everton

45+2 mins

HALF-TIME

Man Utd 1-0 Everton

Manchester United lead, but make dem no dey out of sight. Dem go dey confident of adding more goals afta di break.

Sean Dyche gazz find a way to stem di tide first and den find a way back in to dis.

45+1 mins

Man Utd 1-0 Everton

Save!

Antony take im time, pick im spot and den shoot but Jordan Pickford push am away on di dive.

From di resulting corner, Lisandro Martinez fire wide.

43 mins

Man Utd 1-0 Everton

Back to Manchester United on di front foot.

Aaron Wan-Bissaka – wey dey get beta game – sees as shot deflect ova.

42 mins

Man Utd 1-0 Everton

E get a little bit of ambition wey Everton need.

Dwight McNeil dey set up on di right side of di box for a shot from range wey dem block.

40 mins

Man Utd 1-0 Everton

You no fit say Manchester United no deserve di lead. E no suppose to take dem dis long to find am.

37 mins

GOAL – Man Utd 1-0 Everton

Scott McTominay

Finally, don tell!

Everton no fit get di ball away as Marcus Rashford carri am across di 18-yard line. Dem feed di ball to creator-in-chief Bruno Fernandes, wey pass for di charging Scott McTominay to finish am.

33 mins

Man Utd 0-0 Everton

Bruno Fernandes dey play deep for di midfield but im dey pull more strings dan Geppetto.

Im start anoda attack wit a chipped ball down di right wey end wit am also fireing one shot ova from range.

29 mins

Man Utd 0-0 Everton

How dis match still dey goalless?!

Bruno Fernandes chip one lovely ball ova di top for Marcus Rashford to reach. Im reach di ball first, but im no fit finish am past advancing Jordan Pickford.

27 mins

Man Utd 0-0 Everton

Marcus Rashford na di latest man to see a shot blocked for di Everton box.

So many chances dey, but na zero goals dey.

26 mins

Man Utd 0-0 Everton

Almost a repeat of di Anthony chance from few moments ago!

Dis time na David de Gea’s quick thinking to release am. Ben Godfrey also get back on dis occasion to produce tackle wey im perfectly time.

24 mins

Man Utd 0-0 Everton

E suppose be 1-0

Bruno Fernandes float one correct wonderful pass over Ben Godfrey to release Anthony. E charge in on di goal from di left but im shot lack precision and Jordan Pickford save am.

Surely, we go get one goal soon!

22 mins

Man Utd 0-0 Everton

Dis na really good game.

20 mins

Man Utd 0-0 Everton

Oh, big miss!

Ellis Simms miss sometin wey suppose be goal.

Zero conviction.

18 mins

Man Utd 0-0 Everton

Dis na chance for Everton.

Demarai Gray dey fouled by Tyrell Malacia on di right, near di home box. Dis go go into di danger zone.

12 mins

Man Utd 0-0 Everton

Excellent work from Alex Iwobi!

Anthony drive through di middle and find Marcus Rashford for di box. Just as im dey shape to shoot, Iwobi step in to tackle and concede a corner.

9 mins

Man Utd 0-0 Everton

Save!

Marcus Rashford play low shot wey Everton keeper palm away.

Really good chance.

7 mins

Man Utd 0-0 Everton

And now Everton get corner from a nice little move wey see dem shift di ball right to left.

5 mins

Man Utd 0-0 Everton

3 mins

Man Utd 0-0 Everton

Close!

Manchester United first chance sees Jadon Sancho tuck di ball inside to Marcel Sabitzer, wey turn and fire and see im shot deflect just wide.

1 min – match don start

Man Utd 0-0 Everton

Early half-chance for Everton.

Alex Iwobi play cross into di box and Ellis Simms go for volley wey dem block.

Line-ups Man Utd Formation 4-2-3-1

1 de Gea

29 Wan-Bissaka

5 Maguire

6 Li Martínez

12 Malacia

39 McTominay

8 Bruno Fernandes

21 Antony

15 Sabitzer

25 Sancho

10 Rashford

Substitutes

2 Lindelöf

9 Martial

14 Eriksen

17 Fred

19 Varane

20 Dalot

27 Weghorst

28 Pellistri

31 Butland

Everton Formation 4-1-4-1

1 Pickford

23 Coleman

5 Keane

2 Tarkowski

22 Godfrey

27 Gueye

11 Gray

17 Iwobi

8 Onana

7 McNeil

50 Simms

Substitutes

3 Patterson

4 Holgate

13 Mina

15 Begovic

19 Mykolenko

20 Maupay

26 Davies

30 Coady

37 Garner

Manchester United vs Everton team news

Manchester United midfielder Christian Eriksen go dey available for di first time since January afta e recover from ankle injury.

Luke Shaw dey out wit a thigh problem and Casemiro still dey observe im suspension.

Everton fit dey forced to change dia starting line-up for di first time in five Premier League games due to Abdoulaye Doucoure three-game ban.

Ruben Vinagre don overcome one Achilles problem, while Dominic Calvert-Lewin continue to build im fitness.

Manchester United vs Everton prediction

Football sabi pesin Chris Sutton say Manchester United no dey free-flowing at di moment but dem still try beat Brentford on Wednesday.

E say United dey decent position to make di top four as Tottenham no dey do well, but e dey important for dem to keep pushing on, especially for home.

Everton no go make am easy for dem and since Dyche take charge for January, dem carry more of a threat now, especially from set-plays – but United go still win.

Prediction: 2-1