How Israel Adesanya knockout Alex Pereira to reclaim UFC 287 title

The Last Style Bender

Getty Images

Nigerian-born New Zealander Israel Adesanya don reclaim im middleweight title afta beating long-term rival Alex Pereira.

E beat im main rival under just two rounds for di UFC 287.

‘The Last Stylebender’ produce brutal second-round knockout to seal im victory over di Brazilian fighter and take back di title wey e lose for November last year.

Dis na di fourth time wey di two middleweight dey meet.

Adesanya reclaim im title in style as e deliver a crushing blow mid-way into di second round.

Calf-kicks and jabs, mainly from Pereira bin first dominate di fight as both fighters try to find dia distance inside for di octagon.

And, once dem determine date one di fireworks start.

Pereira look like e begin take di offensive inside di octagon, as e march towards im rival.

Once e notice say im don get advantage, Adesanya follow-up di pressure wit more punched and quickly give am another crushing right wey make Pereira fall.

Di final blow follow and, quickly enough dem end di fight.

Di Nigerian-born fighter rise and bow to im opponent, wey mean say, im don knack am.

‘Di hunter, now di hunted’

Israel Adesanya scream in excitement to im victory.

Di winner for im reaction describe im main rival as di ‘hunter’ wey don become di ‘hunted’.

E say im defeat to Pereira last year make am a better fighter.

“I tell you say di hunter don now become di hunted. I tink I tell dis tin before but thank you. Thank you for beating me,” e tok during im interview in di ring.

E add say “By beating me, e make me a better fighter. A better pesin.

“In dis camp, I no dey play. If you know me, you know say I like a vacation but I no do all of doz tins. I stay on di grind.”

Dis na di fourth time Adesanya and Pereira dey fight but dis na just dia second in di UFC, afta Pereira take di middleweight title last year.

Di Brazilian score a technical knockout victory wey shock di MMA world and leave questions over di legacy of Adesanya.

However, the Style bender return to victory wit ogbonge knockout on Saturday night.