Teams wey don qualify for Champions League last 16

Champions League

Getty Images

Twelve teams don qualify so far for di knock out stage of Champions League afta match day five games.

Four more spots still dey available and more teams go book dia place on di final group matches .

So which teams don qualify for di champions League last 16?

Who don qualify for di last 16?

  • Bayern Munich (GER)*
  • Benfica (POR)
  • Chelsea (ENG)*
  • Club Brugge (BEL)
  • Dortmund (GER)
  • Inter (ITA)
  • Liverpool (ENG)
  • Manchester City (ENG)*
  • Napoli (ITA)
  • Paris Saint-Germain (FRA)
  • Porto (POR)
  • Real Madrid (ESP)

* Dis be confam group winners

See how some of dis teams secure dia qualifications.

Group E
Salzburg 1-2 Chelsea

Champions League

Getty Images

Chelsea qualify for di last 16 afta dem end Salzburg 40-match unbeaten home run for all competitions.

Na Kai Havertz score di winning goal.

Dem go finish top of dia group.

Group H
Paris 7-2 Maccabi Haifa

Champions League

Getty Images

Messi and Mbappé score two goals each as Paris book dia place for di knockout stage in style.

Neymar also score for di match.

Benfica 4-3 Juventus

Champions League

Getty Images

Juventus comeback bin too late as Benfica hold on to reach di last 16.

Juve comot for di group stage of di Champions League for di first time since 2013/14.

Group G
Dortmund 0-0 Man City

Champions League

Getty Images

Both teams get di point dem need to secure di top two spots for Group G match wey dem play for Germany.

Wen be Champions League last 16 draw?

Di Champions League Round of 16 draw dey suppose take place on 7 November, 2022.

E go shele for UEFA headquarters for Nyon, Switzerland.

Di draw go take place exactly five days afta di end of di group stage fixtures on Wednesday, November 2.

We go update dis tori wit more teams as dem finish dia fixtures.