Bukayo Saka, Harry Kane and Jordan Henderson lead England to comfortable win over Senegal

Henderson celebrate

Getty Images

England book dia spot for di quarterfinal of di 2022 World Cup afta dem comfortably defeat Senegal 3-0 for di last 16.

Di 1966 World Cup winners score two goals for di first half through Jordan Henderson and Harry Kane before Bukayo Saka make am three for di 57th minute.

Gareth Southgate boys control much of di game despite di impressive start of di Seneglese for di first half. Di African champions bin test di Three Lions through Boulaye Dia wey test Pickford.

Di quality of England shine through as Jude Bellingham find Henderson wey finish low beyond Edouard Mendy Senegal goal on 38 minutes.

Wit just seconds before halftime, Harry Kane double England lead wit ruthless finish from counterattack.

Saka put di game beyond Senegal before di hour mark as im chip di ball beyond Mendy afta im receive Phil Foden cross.

Di victory mean say England go meet defending champions France for di quarterfinal.

Second half

Bukayo Saka

Getty Images
Saka score England third goal

46 mins – England donbegin dis second half. Dem dey lead Senegal 2-0 and dey set to qualify for di quarter-final if e end like dis.

Senegal make three changes: Pape Matar Sarr, Bamba Dieng and Pape Gueye don enta replace Pathe Ciss, Iliman Ndiaye and Krepin Diatta

48 mins – Harry Kane still dey on di offensive afta im score for di first half but im cross dey cleared by Koulibaly.

56 mins – Kane again waya beta shot wey Mendy save well.

57 mins – Saka! Three nil to England as Bukayo Saka don increase di Three Lions lead. England 3-0 Senegal.

Di Arsenal man produce neat finish from Foden cross to put England for comfortable position to progress.

65 mins – England coach Gareth Southgate don bring on Marcus Rashford and Jack Grealish to replace Phil Foden and Bukayo Saka.

70 mins – Senegal go send on Famara Diedhiou for Boulaye Dia.

74 mins – Pape Matar Sarr try to reduce di deficit but im freekick go wide. E no trouble Pickford for England goal.

76 mins – Kalidou Koulibaly don see yellow card for im foul on Kane.

England go make substitutions. Dem don bring on Eric Dier, Mason Mount for John Stones and John Bellingham.

82 mins – Kalvin Philips don replace Henderson as England don make dia final change.

84 mins – Senegal try to cut England lead, Diedhiou header go over.

Dat na Jakobs last involvement for dis match as Fode Ballo Toure don replace am.

90 mins – Marcus Rashford stretch to meet Grealish cross. Di United forward connect wit am but im shot hit side net.

Di ref don add four minutes before im go blow di final whistle.

90+3 mins – Senegal get freekick to register goal for dis match. Matar Sarr shot hit di wall.

Full time: England 3-0 Senegal

First Half

Harry Kane score England second, im first for Qatar 2022 World Cup

Getty Images
Harry Kane score England second, im first for Qatar 2022 World Cup

1 min – Senegal don take di first kick of di game as dis round of 16 match don start.

5 mins – Boulaye Dia try to force im way into di Three Lions eighteen yard box but both Maguire and Stones snuff out di danger.

8 mins – England dey try to pressure Senegal defence wit some dangerous crosses from set piece but Senegal clear di ball well from causing any danger.

15 mins – Abdou Diallo collect warning from di ref afta im bring down Harry Kane though di ref bin signal play to kontinu.

20 mins – England don get dia first corner of di match, Foden naim go take am. Stones connect wit im Man City teammate cross but im head di ball over.

23 mins – Ismaila Sarr dey ask di referee to go check VAR afta Stones hand touch di ball. Referee Ivan Barton wave im calls away come signal for goal kick.

28 mins – We don play almost half an hour, di score still remain goalless.

32 mins – Good save from Jordan Pickford wey stretch im hand to deny Dia from opening di scoring.

37 mins – Sarr no dey happy wit di ref as Kyle Walker bring am. Di Senegalese forward want make Walker collect yellow but di ref disagree.

39 mins – Goal for England. Jordan Henderson open di scoring as im convert Jude Bellingham cut back. England 1-0 Senegal.

42 mins – England look to increase dia lead as Saka find Kane inside di box wit a cross, di Tottenham Hotspur striker no keep am on target as im shoot over.

45+3 mins – Harry Kane don score im first goal for dis World Cup. England shaperly counter Senegal wit Jude Bellingham stride forward. Im find Foden wey square di ball to Kane and di striker fire di shot past Mendy. England 2-0 Senegal.

Halftime: England 2-0 Senegal

Team lineup

England lineup: 1. Pickford, 2. Walker, 5. Stones, 6. Maguire, 3. Shaw, 8. Henderson, 4. Rice, 22. Bellingham, 17. Saka, 9. Kane, 20. Foden.

Senegal lineup: 16. Mendy, 21. Sabaly, 3. Koulibaly, 22. Diallo, 14. Jakobs, 11. Ciss, 6. Mendy, 13. Ndiaye, 15. Diatta, 18. Sarr, 9. Dia