Justin Bieber perform for popular Indian multi-million dollars wedding

Anant Ambani and Radhika Merchant

Reuters
Anant Ambani and Radhika Merchant wedding don last for months at dis point

Justin Bieber don become di latest in di number of international celebrities wey go perform for di pikin of India richest man and im wife to be as dem still dey prepare to marry.

E enta to perform for Anant Ambani and Radhika Merchant and dia guests for Mumbai dis weekend.

For di couple first pre-wedding party, Rihanna perform, den di second one wey dem do for cruise for di Mediterranean for May, na three international acts perform: Backstreet Boys, Katy Perry and Andrea Boccelli.

So now, everybodi wey don dey look forward to dis wedding, like dis just dey wait for dis weekend for Mumbai.

Although di family neva tok pim for who go perform for di main wedding gan-gan, tori dey go up and down say e be like na Adele dey go oh.

See ehn dis wedding of Mukesh Ambani last born, even sef e big pass di wedding wey dem do for im daughter wey Beyoncé perform inside.

Last weekend, Anant Ambani and Radhika Merchant do dia sangeet ceremony. Dis na di part for Indian wedding wey dem dey dedicate to music and dancing bifor di main wedding gan-gan. And di Ambanis bin go loud ofr di event.

Mukest Ambani, wey be di oga of Reliance Industries wey im net worth na around $115bn, follow im family dance choreography to Shah Rukh Khan hit song Deewangi Deewangi.

Mukesh Ambani (right) and im wife Neet

EPA
Mukesh Ambani (right) and im wife Neet na dem dey run tins for di wedding

Dis weekend na opportunity again make online in-laws take torchlight di clothes wey di guests dem go wear.

Dis na as dem include some of India top ogbonge stars wey go wear cloth for di top fashion designers for di kontri.

E be like as di pre wedding jolly don be like concerts so, e also don turn fashion runway.

Dis na sotay celebrities dey take professional picture of wetin dem dey wia go, post am for social media bifor dem go.

Although how much dem don put for dis wedding neva dey clear.

Tori be say dem give Rihanna $7m for her performance and dem don dey tok say dem go pay Justin Bieber $10m.

Wetin go happun for dis three day wedding like dis, na to watch wen e happun.

But one tin dey sure, some pipo for India go relax say di wedding and all di spending wey enta am go don finish while di pipo for Mumbai go dey hope say di jollification no hook dem for even worse hold up than di one wey di city dey famous for.

Radhika sef no dey tok too much as she tell Vogue US last month say planning dey “go great” come add sat “I dey very excited to dey marry”.

Source