Spain vs France Euro 2024 ogbonge semi-final clash updates

Yamal and Mbappe

Getty Images
Spain na di one of di highest scoring teams for dis tournament

Spain and France go face diasef for di semi-final of di Euro 2024 and dis na one game wey pipo dey anticipate to watch as di outcome go decide who go enta final.

France still dey disappointed say dia forwards Kylian Mbappe and Antoine Griezmann neva score for dem afta surviving every game from group stage.

Mbappe don dey struggle since im get to wear mask afta e break im nose during France opening 1-0 win against Austria.

Spain on di oda side dey win dia game wit confidence.

Spain top di Group B bifor dem beat Georgia 4-1 to set up a quarter-final against host kontri Germany (17:00 BST). Spain also comot Germany for di Euro 2024.

Spain don go 44 years without major trophy bifor dem win di Euro 2008 – wey be di first of three for one row, as dem win 2010 World Cup and Euro 2012.

Dia first trophy since den na from wen dem win di Nations League for 2023.

Spain don keep diasef for front to win a fourth European Championship as Mikel Merino 119th-minute goal bin send dem into di semi-finals.

Spain dey seen as di most-performing team for di Euro 2024 as dem dey live up to expectation.

Spain dey play wit so much aggression, tension and drama as if dem dey determined to win di trophy.

Di 16-year-old star Lamine Yamal gave im third assist for di Euros.

Team news

Spain go dey witout suspended duo Dani Carvajal and Robin le Normand, while midfielder Pedri go dey ruled out of di tournament sake of im knee injury.

One out of Dani Olmo or Merino, wey score wen Spain knock out Germany for di quarter-finals go likely replace Pedri.

For France, dem go welcome back Rabiot from suspension.

Dis na di sixth meeting between Spain and France for any major tournament. France bin win three of di first four (2-0 for Euro 1984 final, 2-1 for Euro 2000 quarter-final, 3-1 for 2006 World Cup last 16).

Spain for di oda hand bin win di most recent game 2-0 for di Euro 2012 quarter-finals. Di oda game na 1-1 draw during di Euro 1996 group stage.

As both team dey meet for di Euro 2024 semi-final, since dem don already meet for di group stage (1996), last round of 16 (2006), quarter-finals (2000 and 2012) and final (1984) of major tournaments.

Spain na di only team wey don win dia five matches for di ongoing Euro 2024.

Ferran and Merino

Getty Images
Spain beat host Germany 2-1 for extra time to qualify for di Semifinals

Spain and France profile

No team for di European Championship history don win six matches for single tournament and no team don eva win six Euros games for one row.

France dey look forward to reach dia fourth Euros final afta di one for 1984, 2000 and 2016.

Na di second final wey dem no play for French soil and na di Euro 2000 for di Netherlands).

Spain dey look forward to reach dia fifth final as na only Germany don play more- six finals.

Di Spaniards don progress from four of five semi-finals, but dem lose on penalties to Italy wey win for dis stage at Euro 2020.

Na only four goals don come out of France five Euro 2024 matches. All 128 non-penalty shots don fail to score (86 for France, 42 for opponents).

France na di only team on record since 1980 wey get more dan 50 non-penalty shots for di Euros and fail to find di net wit any of dem.

Mbappe

Getty Images
France reach di semifinals of di tournament without a single goal from open play.

How you fit follow Spain vs France

Dis game go kick off by 20:00 BST (8pm) on Tuesday 9 July and you fit follow live on BBC Pidgin wit full live text updates.

Source