Who dey di list as Tinubu fire five ministers, reassign 10 and nominate seven new ones

Barr. Uju-Ken Ohanenye

BBC

President Bola Tinubu don sack five ministers wey dey im cabinet.

Di presidency bin announce di discharge of di ministers on Wednesday 23 October 2024 following di federal executive council (FEC) meeting.

One of di ogbonge minister wey dey in charge of Ministry of Women Affairs, Barr. Uju-Ken Ohanenye dey among those wey dey affected.

Dis sack dey come weeks afta Tinubu tok say im wan change di pipo wey dey im cabinet.

Also, president Tinubu don also appoint Bianca Odinaka Odumegu-Ojukwu as Minister of State Foreign Affairs.

President Tinubu also announce di appointment of Shehu Dikko as Chairman of di National Sports Commission.

Also, Sunday Dare go now serve as Special Adviser to di President on Public Communication and Orientation working from di Ministry of Information and National Orientation.

Ministers wey Tinubu announce dia discharge

  • Barr. Uju-Ken Ohanenye- Minister of Women Affairs
  • Lola Ade-John – Minister of Tourism
  • Prof Tahir Mamman SAN OON – Minister of Education
  • Abdullahi Muhammad Gwarzo – Minister of State Housinf and Urban Development
  • Dr. Jamila Bio Ibrahim – Minister of Youth Development

Di new ministers Tinubu nominate

  • Dr Nentawe Yilwatda – Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Reduction
  • Muhammadu Maigari Dingyadi – Minister of Labour & Employment
  • Bianca Odinaka Odumegu-Ojukwu – Minister of State Foreign Affairs
  • Dr Jumoke Oduwole – Minister of Industry, Trade and Investment (Trade and Investment)
  • Idi Mukhtar Maiha – Ministry of Livestock Development
  • Rt. Hon. Yusuf Abdullahi Ata – Minister of State, Housing and Urban Development
  • Suwaiba Said Ahmad PhD – Minister of State Education

Ministers wey Tinubu reassign

Some ministers wey dey di current administration also collect new post away from di ministry wey dem dey bifor.

Di ministers incldue:

  • Hon Dr. Yusuf Tanko Sununu wey be Minister of State for Education go become Minister of State Humanitarian Affairs and Poverty Reduction
  • Dr. Morufu Olatunji Alausa wey be Minister State for Health go now be Minister of Education
  • Barr. Bello Muhammad Goronyo wey be Minister of State, Water Resources and Sanitation go become Minister of State Works
  • Hon. Abubakar Momoh wey be Minister of Niger Delta Development go now become Minister of Regional Development
  • Uba Maigari Ahmadu wey be Minister of State Steel Development go now function as Minister of State Regional Development
  • Dr. Doris Uzoka-Anite wey be Minister of Industry, Trade and Investment go now become Minister of State Finance
  • Sen. John Enoh wey be di Minister of Sports Development wey di president don scrap. Go now function as Minister of State Trade and Investment [Industry]
  • Imaan Sulaiman-Ibrahim wey dey function as Minister of State, Police Affairs go now become Minister of Women Affairs
  • Ayodele Olawande wey be Minister of State for Youth Development go now become Minister for Youth Development
  • Dr. Salako Iziaq Adekunle Adeboye wey formerly be Minister of State, Environment go become Minister of State, Health

Which ministries dey affected as Tinubu announce scrapping and merging?

President Tinubu don also scrap di Niger Delta Ministry and di Ministry of sports development including some oda ministries.

Di announcement of di scrapping of ministries, merging and creation of odas bin also take place on Wednesday during FEC meeting.

FEC also agree to create a ministry wey go oversee all di regional development commission wey dey bifor.

Which ministries dey scrapped

Niger Delta Ministry

FEC scrap Niger Delta Ministry and the Ministry of sports development.

Meanwhile, di ministry of Niger Delta dey created on 10 September 2008 by former president Musa Yar’Adua, but di ministry begin operation for February 2009.

Di ministry bin dey created to torchlight di development issues and challenges including unemployment wey dey face di Niger Delta region for Nigeria.

Wen president Tinubu enta office, e appoint Engr. Abubakar Momoh as di minister wey go dey in charge of di Niger Delta Development ministry.

Ministry of sports development

Di executive council also scrap di ministry of sports development.

Bifor, dis ministry bin dey responsible responsible to form and monitor policies and programmes wey dey promote sports development and physical fitness across di kontri.

Meanwhile, through several years, dis sport ministry don get different names.

Some of di name include: National Sports Commission (1992 – 1995), Federal Ministry of Youth and Sports (1995 – 1999), Federal Ministry of Sports and Social Development (1999 – 2007), National Sports Commission (2007 – 2015), Federal Ministry of Youth and Sports Development (2015 – 2023).

By 2023, di ministry get di name federal Ministry of Sports Development headed by SenatorJohn Owan Enoh as Minister.

However, di president don assign di role of di sports ministry to anoda commission, di National Sports Commission.

Wetin go do di development commission?

Di presidency announce say all di development commissions wey dey exist bifor go now dey under di ministry of regional development.

Di affected commission na Niger Delta Development Commission, North West Development Commission, South West Development Commission and North East Development Commission.

Bifor, dis commission dey address issues wey related to dia regions.

Ministries wey dem merge

Tinubu and FEC also merge di Ministry of Tourism wit di Ministry of Culture and Creative Economy.

Lola Ade-John bin dey appointed by President Tinubu as minister to oversee di Tourism ministry wit di mission to build Nigeria cultural tourism, attract visitors from around di world to di kontri.

For di same vein, di Ministry of Culture and Creative Economy headed by Barrister Hannatu Musa Musawa bin dey expected to oversee di creative future of Nigeria and to driving Nigeria recognition for di global stage.

But now, both ministries don dey merged as one.

Source