How FG plan to share N50,000 to help 100,000 homes for states across Nigeria?

President Bola Ahmed Tinubu don direct di sharing of money to plenty plenty families for di 36 states of Nigeria as part of goment effort to reduce di hardship wey pipo dey face.

For di National Economic Council meeting on Thursday, di presido tok say goment go distribute “N50,000 uplift grant each to 100,000 families per state for three months”.

Dat na N5 billion per state, N185 billion for di 36 states plus FCT, and N555 billion for di three months.

Dis project follow for a new ‘National Construction and Household Support Programme’ wey Presido Tinubu tok say im administration dey kickstart.

Di programme go also include “deployment of N155 billion to buy and sell assorted foodstuff wey goment go distribute across di nation”.

Oda tins wey follow for this support programme wey federal goment wan start na:

  • FG go give states and FCT N10billion each to buy CNG buses for mass transit to reduce transportation cost.
  • Goment go make provisions for Labour and Civil society organisations. E neva dey clear wetin dis provisions go be
  • Goment go do fast fast construct di Sokoto-Badagry Highway, wey go connect Sokoto, Kebbi, Niger, Kwara, Oyo, Ogun, and Lagos. Dis na sake of easy transportation of food produce from di north to di western parts of Nigeria
  • Tinubu also approve money to complete di Port Harcourt-Maiduguri Railway; wey connect Rivers, Abia, Enugu, Benue, Nasarawa, Plateau, Bauchi, Gombe, Yobe and Borno

How goment go select families wey go benefit?

Di statement wey Ajuri Ngelale, di toktok pesin for President Tinubu, bin release, no get clear explanation about how dem go choose families.

Oga Ngelale no dey reachable wen BBC Pidgin call am for more explanation on Friday. E no also reply message wey we send am.

Dis no be di first cash grant wey Presido Tinubu dey share to poor pipo and households. For 2023, Tinubu announce one ‘Conditional Cash Transfer’ programme.

E say goment go dey pay N8000 evri month give 12 million poor and low-income households for a period of six months.

Dat time, to qualify for di scheme you must fulfil certain conditions.

Goment say di moni na for pipo wey dey earn less dan $1.95 or N1500 in a day, and di names of pipo wey fall under dat bracket dey inside di National Social Register.

Na informate from dat register goment go use pay pipo di money.

But for inside di statement on Thursday, Tinubu tok say “states must work together to deliver on di critical reforms required of us to meet di needs of our people”.

During di time of president Buhari, e start a program – National Social Safety Nets Project – wey create a ‘National Social Register’.

Dis register get information about pipo wey go dey benefit from goment social assistance programs across all di states and di FCT; and by di time Buhari tenure finish, goment tok say di list contain over 16 million households, and more dan 61 million vulnerable pesin wey don register.

Na di register FG bin take dey pay poor pipo N5000 every month for di cash transfer project wey Buhari bin start.

However, two months afta Tinubu take ova, in July 2023, di National Economic Council – wey get all di state govnors as members – tok say dem no go use dat social register again sake of say e no dey credible.

Anambra State govnor, Chukwuma Soludo bin tell tori pipo dat time say NEC agree make states come up wit dia own registers “using formal and informal means”.

So di state social registers fit be one of di options to use for di disbursement of di N50,000 to di housholds wey go benefit.

Source