Wetin dey inside di Oronsaye report wey Tinubu approve for ‘full implementation’

Nigeria President Bola Tinubu don approve di full implementation of di Stephen Oronsaye Panel report.

Di decision come from di Federal Executive Council, FEC, meeting wey President Tinubu preside over on Monday, 26 February for di State House Abuja.

Di 2012 Stephen Oronsaye report bin recommend merging, scraping and relocation of some parastatals and agencies to cut cost of governance

Afta di FEC meeting, officials release statement say dem don decide to implement di recommendations of di Steve Oronsaye panel on restructuring and rationalisation of federal agencies, parastatals and commissions, in order to support efficiency for di federal service and reduce di cost of governance.

For one statement wey Special Adviser Information and Strategy to President Tinubu, Bayo Onanuga post on X, e say di Tinubu administration don decide to face di monster of high governance cost by implementing elements of di report.

E say di implementation go involve merging, subsuming and scrapping of agencies wey dey perform similar functions.

“Di president don set up one eight-man committee to ensure say di necessary legislative amendments and administrative restructuring dem need to implement di reforms dey effected.

Pipo wey dey di committee include di Secretary to di Government of di Federation, Head of Civil Service, Attorney General of di Federation, Budget and Planning Minister, DG Bureau of Public Service Reform and di Special Assistant to di president on National Assembly. Di Cabinet Affairs Office go serve as di secretariat.” Oga Onanuga tok for di statement.

Key tins to sabi about di Stephen Oronsaye Panel report

For 2011, former Nigeria President, Goodluck Jonathan bin set up di Presidential Committee on Restructuring and Rationalisation of Federal Government Parastatals, Commissions and Agencies, under di leadership of former Head of Civil Service, Stephen Oronsaye.

Di Presidential Committee get di following members – Stephen Oronsaye, Chairman; Japh CT Nwosu, Member; Rabiu D. Abubakar, Member; N. Salman Mann, Member; Hamza A. Tahir, Member; Adetunji Adesunkanmi, Member and Umar A. Mohammed, Member.

For April 2012, di committee submit one 800-page report, wey establish say na 541 Federal Government parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey.

Di report reveal high level of competition among dis several agencies wey dey perform similar roles, and dis no only dey create unhealthy rivalry among dem but e also bring about unnecessary wastage in government expenditure.

Di panel bin recommend say make government reduce 263 of di statutory agencies go 161, scrap 38 agencies, and merge 14 agencies to departments for ministries.

Di panel also recommend di discontinuation of government funding for professional bodies and councils. Dem say dis measures go free funds for di much-needed capital projects across di kontri.

Former President Goodluck Jonathan no implement di report but for March 2014, e set up one White Paper Drafting Committee wey di den Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Mohammed Adoke head to study di recommendations and produce a White Paper on di report.

President Bola Tinubu wen e assume office for 2023, bin notify professional bodies and councils say dem go stop to dey fund dem beginning from di 2024 budget in line wit di decisions of di Presidential Committee on Salaries (PCS).

“I wish to inform you say di presidential committee on salaries (PCS) for dia13th meeting don approve di discontinuation of budgetary allocation to professional Bodies/Councils effective 1st January, 2024. You will be required, effective 1st January 2024, to be fully responsible for your personnel, overhead and capital expenditures.” E tok.

Meanwhile, wen di immediate-past President Muhammadu Buhari step into power for 2015, e promise say im go implement di recommendations on di Oronsaye report.

Buhari Administration bin establish di Bukar Aji Committee to review di White Paper wey di Whitepaper Committee wey Goodluck Jonathan administration prepare.

For April 2020, The Cable bin report say President Muhammadu Buhari don approve di implementation of di report.

Di den minister of finance, budget and national planning, Zainab Ahmed bin tell tori pipo afta one Federal Executive Council Meeting say dem don forward di president approval to di head of civil service plus to di secretary to di government of di federation.

“Di president don approve dat dis administration go implement di Oronsaye report.

“Dis na report wey don dey in place for a long time but den no implementation but di president don approve am say dem must implement am and we don send Mr President approval go di arms of government wey dey responsible for dis and dat na di office of di head of di secretary to di government of di federation and di head of di civil service.” Ahmed tok.

As at di time dem submit di Oronsaye report, na 541 government parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey for di kontri, but now e don increase.

At present, di number of federal agencies, commissions and parastatals don increase and e dey estimated to dey close to 1000, according to one report by The Cable.

Agencies wey dem go merge

  • National Salaries, Income and wages Commission go dey under Revenue Mobilisation and Fiscal Commission. Di National Assembly go need di amend di constitution as RMAFC dey established by di constitution.
  • Dem go merge Infrastructure Concession and Regulatory Commission wit Bureau of Public Enterprise and di name go change to `Public Enterprises and Infrastructural Concession Commission.
  • National Human Rights Commission go swallow Public Complaints Commission.
  • Dem go scrap di Pension Transitional Arrangement Directorate (PTAD) and di Federal Ministry of Finance go take ova dia functions.
  • NEMA and National Commission for Refugees go join togeda to become National Emergency and Refugee Management Commission.
  • Border Communities Development Agency go become department under National Boundary Commission.
  • NACA and NCDC go dey joined togeda.
  • SERVICOM go become department under di Bureau for Public Service Reform(BPSR).
  • NALDA go return to di Ministry of Agriculture and Food Security.
  • Federal Ministry of Science go supervise one new agency wey go combine NCAM, NASENI and PRODA.
  • National Commission for Museums and Monuments and National Gallery of Arts go become one entity wey go dey known as National Commission for Museums, Monuments and Gallery of Arts.
  • National Theatre go dey merged wit National Troupe.
  • Directorate of Technical Cooperation for Africa and Directorate of Technical Aid Corp go dey merged under di Ministry of Foreign Affairs
  • Federal Radio Corporation and Voice of Nigeria go become one entity to be known as Federal Broadcasting Corporation of Nigeria.
  • National Biotechnology Development Agency (NABDA) and National Centre for Genetic Resources and Biotechnology go dey merged into one agency wey go dey known as National Biotechnology Research and Development Agency(NBRDA).
  • National Institute for Leather Science Technology and National Institute for Chemical Technology go become one agency.
  • Nigeria Natural Medicine Development Agency and National Institute of Pharmaceutical Research and Development go become one agency.
  • Di National Metallurgical Development Centre and National Metallurgical Training Institute go dey merged.
  • National Institute for Trypanosomiasis go dey under di Institute of Veterinary Research in Vom, Jos.

Oga Onanuga say dem still dey chook eye for di list of agencies, parastatals and commissions wey go dey affected.

Source