Quincy Jones, giant of US music wey work with Michael Jackson die at di age of 91

Quincy Jones

Getty Images
Na Jones produce Michael Jackson Thriller album

Quincy Jones, di musician and producer wey work wit Michael Jackson, Frank Sinatra and many odas, don die at di age of 91.

Jones publicist, Arnold Robinson, say im “die peacefully” on Sunday night for im house for Bel Air.

“Tonight, wit full but broken hearts, we must share di news of our father and brother Quincy Jones’ death. And although dis na ogbonge loss for our family, we dey celebrate di great life wey im live and we know say we no go see anoda pesin like am,” di family write for statement.

Jones make name as di producer of Michael Jackson Thriller album.

Im career stretch more dan 75 years. During dat time, im win 28 Grammy awards and Time Magazine name am as one of di most influential jazz musicians of di 20th century.

Im produce and conduct di recording of di 1985 charity record, We Are di World.

Na im also compose di soundtrack to more dan 50 films and TV programmes including Heat of di Night, Di Color Purple and Di Italian Job.

Early on for im career, Jones bin work closely wit Frank Sinatra and re-work Sinatra classic Fly Me To Di Moon – im take am from a waltz to a swing.

For di feem film Di Wiz, Jones find imself dey work alongside a 19-year-old Michael Jackson.

Di two work togeda for plenty years and Jones produce albums Off di Wall, wey sell 20 million copies.

Na im produce Thriller and Bad for di pop star.

For 1985, Jones gada 46 of America most popular singers dat time, including Jackson, Bruce Springsteen, Tina Turner and Cyndi Lauper to record We Are Di World.

Jones follow-write di song to raise money for pipo wey dey suffer from famine for Ethiopia.

Di record na US equivalent to Band Aid song Do They Know It’s Christmas.

Di hit reach number one for UK and US and dem perform am Live for Aid.

Michael Jackson and Quincy Jones

Getty Images
Jones produce three of Michael Jackson albums

Jones also compose di soundtrack to more dan 50 feems and TV programmes including di 1969 British feem, Di Italian Job.

For di big screen, im produce di feem Di Color Purple wey introduce di public to two den unknown performers – Oprah Winfrey and Whoopi Goldberg.

For small screen, na im be one of di producers behind di hit TV show Di Fresh Prince of Bel Air.

But na music wia Jones excel – im win multiple Grammys, including one legend award for 1992, to add wit Emmys, Tony’s and Oscars wey recognise am too.

Jones marry three times and get seven children, im children include music producer Quincy Jones III and actress Rashida Jones, wey dey known for di US version of Di Office.

Jones family say di music producer na “truly one of a kind” and “through im music and im boundless love, Quincy Jones’ heart go beat for eternity”.

Among those wey pay tributes, na playwright Jeremy O’Harris, im write for X say Jones “contributions to American culture dey limitless”, e add say na im be di first black pesin to collect nomination for Oscar for best score among im oda achievements.

Source