Who be Kenya new deputy president Kithure Kindiki?

Kenyan govment don swear-in a new deputy president Kithure Kindiki afta gbege wey happun wen dem impeach Rigathi Gachagua.

Na two-thirds of di 67 senators for Kenyan parliament bin vote to impeach former deputy president Gachagua on charges wey include corruption, inciting ethnic divisions and undermining di goment.

Kindiki dey replace Gachagua on Friday, afta president William Ruto bin nominate am go di senate house for consideration.

President Ruto bin quickly nominate di former Interior Minister Professor Kindiki as di new deputy president, and 236 lawmakers approve am inside a roll-call vote.

Kindiki bin fall out wit President Ruto, just two years afta Kenyans elect dem on joint ticket.

Afta di impeachment, di law bin give di president 14 days to nominate a replacement and a further 60 days for a vote by lawmakers.

‘I go dey loyal’- new deputy president

Di newly sworn-in deputy president Kindiki say e go dey loyal and faithful as e take charge of di position.

Who be Prof Kithure Kindiki?

Bifor president Ruto bin announce Kindiki, e dey incharge of di interior ministry.

Di 52-year-old Kindiki na strong ally of di president and bin serve as im lawyer during im trial for crimes against humanity for di International Criminal Court (ICC) wey dem eventually dismiss becos of lack of evidence.

Prof. Kindiki get im Bachelors degree in Law (LLB) from Moi University and a Diploma in Legal Studies from di Kenya School of Law.

E also get Masters degree in International Human Rights Law & Democracy and PhD in International Law, both from di University of Pretoria, South Africa.

Prof. Kindiki bin also lecture for di Moi University. E also serve as a Senior Lecturer and di Head of di Department of Public Law for di University of Nairobi.

E rise to be Associate Dean for di School of Law in di same institution.

E also serve as di Secretary of National Cohesion under President Mwai Kibaki.

Prof. Kindiki na immediate former Senator from Tharaka-Nithi County.

Dem first elect am for 2013 and dem re-elect am in 2017.

E be di Senate majority leader during di 2013–2017 term and di deputy speaker of di Senate from August 2017 to 2020.

Asides im experience in politics, Prof. Kindiki bin don also consult for local and international organisations including United Nations High Commissioner for Refugees (UNHCR) and United Nations Development Program (UNDP) among others.

E be a member International Commission of Jurists, Kenya Chapter (ICJ-K).

Now e don rise reach di position of Kenyan deputy president.

Allegations wey dem sama former deputy president Rigathi Gachagua

Gachagua bin chop accuse say e acquire assets wey worth 5.2bn Kenyan shillings ($40m; £31m) inside di two years since e become deputy president – allegedly acquire through corrupt means.

Di former deputy president say most of di properties in question na from im late brother estate.

During di trial, one of Gachagua lawyers, Elisha Ongoya, tok say all di allegations against di deputy president na “either false, ridiculous or embarrassing”.

Andrew Mulwa, former chief executive of di Kenya Medical Supplies Agency wey be di second witness, bin face tough questions ova im allegations say e dey intimidated by one call from di deputy president to return documents for one cancelled tender for mosquito nets wey di president dey accused say e interfere wit.

“Dis na di first time I receive call from a sitting Deputy President and request for documents wey dey under investigations. Oga Speaker, for my 15 years of public service, I neva dey asked to do dat,” e tok.

Gachagua don deny di allegation and describe am as “ridiculous and baseless”, and im legal team don point out say dis bin come wen di process don already dey completed, and argue say no money dey lost.

One third witness, Abdi Mohamud, di deputy chief executive of di Ethics and Anti-Corruption Commission, give evidence ova allegations of conflict of interest wey relate to di mata as well as allegations say di deputy president bin receive gifts in form of cows from di public.

Source