Why we arrest Bobrisky again – EFCC

Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don confam di arrest of celebrity crossdresser Idris Okuneye wey dey popular as Bobrisky.

Tori bin dey fly upandan say di anti-corruption agency arrest Bobrisky for airport wen im bin wan travel.

Tok-tok pesin for EFCC, Dele Oyewale confam to BBC Pidgin say true- true dem arrest Bobrisky.

“Na on Thursday evening we arrest am for Lagos” Oga Oyewale tok.

Why EFCC arrest Bobrisky

Di Economic and Financial Crimes Commission say dem no just arrest Bobrisky to wicked or punish am, but im get unfinished business with dem.

According to di EFCC tok-tok pesin, dem arrest Bobrisky so dat im go fit write statement sake of di bribery allegations wey im sama on some EFCC personnel.

“We fly am to Abuja to face di investigators of di case, we need am to make a formal statement to dat effect.” im conclude.

Di EFCC no tok di exact time wen dem go release am, but dem say dem go release am wen im write di statement finish.

Recently, Idris Okuneye dey always dey for news, sake different types of controversial tori wey dey drag di leg of di crossdresser come outside.

Di recent kasala bin start wen social media influencer Martins Otse, alias Very Dark Man (VDM) come out for one video wey bin circulate on social media wia e play audio recording wey involve two pipo.

Na for di video, Very Dark Man claim say Bobrisky dey tell pesin for phone say im pay 15 million naira to unnamed EFCC officers to avoid prosecution for alleged money laundering.

E also allege say Bobrisky no serve im jail term for prison.

Di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, bin direct investigation into di allegations of bribery and corruption within Nigerian Correctional Service (NCoS) wey involve Bobrisky.

For October 2024, few weeks afta, di Investigative Panel wey di Minister of Interior Olubunmi Tunji-Ojo bin set up to torchlight di allegations bin come out to say dat dem no see any evidence wey suggest say Bobrisky bin sleep outside di Custodial Centre during di period of im imprisonment.

But, di report say e enjoy some privileges for prison wey include “specially furnished single cells, humidifier, plenty visitation by im family members and friends as e wish, family members and friends dey visit am well-well for inside di office of di pesin in-charge of di custodial center, floor rug, self-feeding.

Dem include say e get inmate wey dey help am run errands, e get access to fridge and television, and possibly access to im phone.”

As dis dey happun, Nigeria Immigration confam say dem arrest Bobrisky wen e dey try to comot di kontri through Seme – a border town between Benin Republic and Nigeria through Lagos.

Between 2016 to 2024 Bobrisky don do plenti tins and enta plenti tori.

E become popular and kontinu to dey grow during dis period sotay for 2017, im announce say im go begin dey charge N10,000 for viewers wey wan join im Snapchat.

Bobrisky say im go dey show viewers live bathroom sessions, makeup and dancing videos.

From dia, Bobrisky declare imsef as ‘Queen of Snapchat’.

For September 2019 Bobrisky make headlines wen tori break say police lock di venue wia di popular celebrity wan use celebrate im birthday.

Dis news cause plenti tok-tok on top social media dat year and wen Bobrisky go tok, e appear for snapchat wia e open up say e spend over 19 million naira to plan di party.

To clarify di issue, di den Lagos police tok-tok pesin Bala Elkana tell BBC say na sake of intelligence make dem stop di party.

Wetin be di intelligence? Dem no tok am dat time.

For 2021 Bobrisky kontinu to dey use social media especially Tiktok to grow im brand.

Na part of how Bobrsiky find im way into heart of many Nigerians be dis.

Sometimes, Bobrisky go go live for im social media accounts to begin tok different tins – some dey funny, some na warning to ‘haters, while some na how e dey live im daily life as di ‘Mummy of Lagos’.

Source