Canada issue travel alert, suspend operations for Nigeria afta fire incident for dia embassy

Canada High Commission for Nigeria don temporarily suspend dia operations for di kontri until further notice.

Di embassy wey announce dis informate on X (former Twitter) also issue travel advisory wey warn against non-essential travel come di West African kontri.

Dis announcements dey come afta one fire incident occur for di High Commission Office for Abuja, di kontri capital on Monday, 6 November, wey lead to di death of two pipo and oda pipo wey injure.

Although, di cause of di fire outbreak neva dey clear, di Canadian Foreign Minister, Melanie Joly for one statement on X, tok say dem dey work to find out wetin cause di fire.

She tok sorry to di families of pipo wey die for di tragedy.

Di commission also release emergency numbers and emails, Canadian citizens wey need assistance fit call, but di page say dem no get information about immigration, permanent residence or visas.

The High Commission of Canada to #Nigeria, in #Abuja, has temporarily suspended operations until further notice. For…

Posted by High Commission of Canada to Nigeria on Monday, November 6, 2023

Meanwhile Nigeria President Bola Ahmed Tinubu bin don tok sorry to di Canadian government, diplomatic community, and all pesins wey dey affected by di fire incident wey happun on Monday for di Canadian High Commission for Abuja.

Di president assure di Canadian authorities of di full support of di Nigerian government to aid di diplomatic and local staff of di High Commission wey dey particularly affected by di incident.

According to statement wey Federal Capital Territory, FCT Emergency Management Agency tok-tok pesin Nkechi Isa sign, na one diesel tank explode for di generator house inside di Canadian Embassy for FCT.

Two pipo die and t dey hospital for di National Hospital Trauma Centre with serious burns.

Di incident happun at about 10:45am on Monday.

Tori be say one five man team bin dey service two MIKANO engines as one of di power generating set bin get fault, while dem bin dey service di oda one.

Di fire happun wen di tank of diesel for di generator house, containing 2000 litres explode.

Two of di personnel wey dey service di generator get fatal injuries and two survive.

FCT Fire Service dey able to contain di fire around 12.30 pm.

Di victims be Nigerians.

Avoid non-essential travel to Nigeria – Canada issue travel advisory

Canada goment don also release travel advisory for dia citizens wey dey Nigeria and di ones wey get plan to visit di kontri.

For di latest advisory dem release on 6 November, dem advise dia citizens to:

Avoid non-essential travel to Nigeria, including for Abuja. Dem say na sake of di unpredictable security situation throughout di kontri plus di significant risk of terrorism, crime, inter-communal clashes, armed attacks and kidnappings.

Wit orange security alert.

Regional risk level – Avoid all travel

Wit red security alert, di commission advise travellers to:

Avoid all travel – go di following regions sake of di risk of terrorism, armed attacks, kidnapping, inter-communal and sectarian violence:

  • di north-western states of Kaduna, Kano, Katsina, Sokoto and Zamfara
  • di north-central states of Plateau and Kogi
  • di north-eastern states of Adamawa, Bauchi, Borno, Gombe, Jigawa and Yobe
  • di Niger Delta states of Akwa Ibom, Anambra, Bayelsa, Delta, Imo and Rivers (wit di exception of Rivers’ capital city, Port Harcourt, wia we advise against non-essential travel).

Wit Yellow secured alert, dem advice travellers to exercise high degree of cation for Calabar and Lagos.

And make dem exercise a high degree of caution for inside di cities of Calabar and Lagos sake of incidence of crime.

Canada travel advisory dey come afta America recently, issue security alert wey warn of high threat on major hotels for Nigeria larger cities.

Di embassy for inside one statement on dia website wey dem issue on Friday 3 November tok say “America goment dey aware of credible information on elevated threat to major hotels for Nigeria.”

However, di statement add say Nigerian security services dey work hard to counter di threat.

Source