UK red list countries: United Kingdom travel restrictions go put Nigeria on red list

From Sunday 5 December, 2021 all travellers from Nigeria to UK go face new restrictions.

UK go add Nigeria to red list kontries on Monday, UK Health Secretary Sajid Javid announce on Saturday.

Di red list na kontries wey pipo from dia must quarantine for hotel for 10 days

“Ova di recent days we don learn of significant number of growing cases linked to travel with Nigeria.”

“We get 27 cases already inside England and dat dey grow and Nigeria now na second only to South Africa in terms of linked cases to Omicron.”

According to UK goment, travellers wey dey come UK go now gatz to take Covid test before dem depart as part of effort to limit spread of coronavirus.

Di Health Secretary say di tightened requirements go come into effect from 04:00 GMT on Tuesday.

Travellers go dey required to submit evidence of negative lateral flow or PCR test to enter.

Presently, pipo only need to self-isolate until dem test negative within two days of arriving.

Oga Javid say di goment strategy since di discovery of Omicron variant na to “buy time” to assess and to “put in place protective measures”.

E say di goment bin don dey clear say dem go take action if e dey necessary.

“We don always tok say we go act swiftly if new data require am”.

E add say e dey important to remember vaccinations “no be our first line of defence”.

Di UK official call on pipo to get booster dose of Covid vaccine wen dey call dem to do so by the NHS.

Dis moves dey come afta pressure on di goment to tighten di policy begin plenti more-more during di week.

UK travel restrictions update for Nigeria

UK red list countries: UK travel restrictions go put Nigeria on red list over Omicron

Reuters

From 0400GMT on Monday 6 December, 2021 Nigeria go join red list for entering England.

Dis go need those travelling from and returning to di UK to check a must do requirement to fit travel abroad and enter England, Scotland, Wales or Northern Ireland.

From 5 December 2021, all out-bound passengers from Nigeria go dey required to provide either valid evidence of full vaccination against Covid-19 or a negative PCR test result within 48 hours of departure.

You go dey responsible for organising your own COVID-19 test, in line with any UK govment testing requirements.

Dem advice make travellers contact local authorities for information on testing facilities.

If you plan to pass through anoda kontri to return to di UK, check di travel advice for di kontri you dey transit from, di UK Foreign Office advice.

You must book your hotel quarantine package before you start your journey to di UK, di Foreign Office tok.