Alau dam burst, wild animals escape and wetin we know about Maiduguri flood wey don render many homeless

Flood water from an overflowing dam has destroyed tens of houses in Maiduguri, the capital city of Borno state in northeast Nigeria.

Getty Images

Hundreds of Maidguri residence don forcefully run commot from dia homes to seek refuge in oda communities as Alau dam burst sake of di heavy rainfall in di region.

Di dam wey dey located 20km away from Maiduguri, capital of Borno state don collapse due to di heavy flood.

Tori be say Alau Dam don damage sake of high rainfall and e don cause flooding for di communities along di riverine areas, including major roads, schools and hospitals.

Di flood severely affect several communities, include Adamkolo, Fori, Galtimari, Gwange, and Bulabulin.

Di latest hit don affect animals as dem dey covered in flood water, dey waka anyhow on di streets, and dey put pipo lives in danger.

Usman Tar, di State Commissioner for Information and Internal Security, don send flood alert on Tuesday, as im tell residents make dem protect demsef and comot from flood-prone areas.

“Due to di unusually high volume of water dis year, we advice all di residents wey dey live along river bank to take immediate action to protect demselves and dia properties,” e tok.

In 30 years, dis na di worst overflow wey don happun for Alau Dam, causing di state goment to shut down schools.

Govnor of Borno State, Babagana Zulum on Tuesday approve for evri school for di state, both goment and private to close for two weeks sake of severe flooding wey dey happun for di dia.

Inside one ne statement from di State Ministry of Education, Science, Technology and Innovation tok say wetin cause di flooding na damage to di Alau Dam, wey be di major water reservoir for di state.

However, president Bola Tinubu, send im condolence to di families of di pipo wey dia livelihood “due to di disaster cause by di overflow of di Alau Dam.”

Di president assure di state, govnor Zulum say di federal goment dey ready to collaborate wit dem to address di immediate humanitarian needs of di affected pipo.

E don order NEMA to assist di flood victims.

“President Tinubu extend im heartfelt condolences to di goment and pipo of di state, especially to di families wey don lose dia means of livelihood due to di disaster cause by di overflow of di Alau Dam,” Bayo Onanugu, tok-tok pesin for di president.

“While relevant authorities still dey assess di damage cause by di flood, di president call for di immediate evacuation of pipo from affected areas.”

Director General of NEMA, Zubaida Umar tok say dem don begin di evacuation of residents in di affected areas and dem go provide dem wit food, shelter, and medical assistance.

She explain say di Borno state goment don open Bakassi camp to accomodate pipo wey dey affected by di flood.

“Borno State goment don open up Bakassi Camp to accommodate dos displaced by di flood. We dey work, alongside di Borno State Emergency Management Agency, in providing humanitarian assistance to di distressed in di camp,” di director tok.

Residents dey carry dia belongings on a motorcycle for Maiduguri becos of flood water

Getty Images

Aminals escape from di zoo

Officials from one zoo for di Northeastern state say some wild animals don escape from captivity afta flooding hit Borno state.

Videos of some of di creatures on di streets of di state capital, Maiduguri, dey circulate on top social media.

Ali Donbest, wey dey run di Sanda Kyarimi Zoo, tell di BBC say e no know di exact numba of animals wey don free demselves but dem dey try locate dem. E tok say dem don find one ostrich while im advise residents make dem dey careful.

Local media dey report say Maiduguri dey experience flooding on high scale, wey pipo neva experience in three decades, wit many forced to comot from dia homes.

Oga Donbest tok say dem don find some of di animals wey escape.

“We don recapture di ostrich wey dem see on di street and we also receive call say dem don find di crocodile for anoda location but we no fit get dia due to di flood,” e tok.

E also tok say di cages wia di lions and hyenas dey, flood water don surpass am but e no fit tell if dem don escape.

Maiduguri resident Ishaq Sani tell di BBC say im biggest fear at di moment na to come across wild animal.

E abandon im home due to di floods and now e dey stay wit im friend for anoda location.

Report neva dey of animals attacking humans.

Source