Timothy Adegoke update: Court dismiss ‘no case submission’ wey Adedoyin and odas file say dem no get hand for di murder

Di Osun State High Court don dismiss one “no case submission” wey di counsels to Rahman Adedoyin and seven odas file as dem dey face trial for di alleged killing of Timothy Adegoke.

Timothy Adegoke na di NBA student of Obafemi Awolowo University, OAU who wey dem declare say dey miss and later find am dead.

Di prosecution counsel, M.O Omosun bin want di court to dismiss di case by all di defendants as dem don establish prema facie based on all evidences presented before di court.

For her ruling, Justice Adepele Ojo consider all exhibits wey all witnesses present and di one wey court bin admit as evidence and tok say a prema facie, no mean say di prosecution counsel must prove di case beyond reasonable doubt.

Di judge say prosecution dey able to established a prema facie through all di witnesses, dat Timothy Adegoke lodged for di Hilton Honour Hotel, Ile-Ife and dat im body dey interfered with and disrespectfully evacuated.

She den discharge di “no case submission” filed by counsels to all di defendants and order dat they enta dia defence.

Responding to di ruling, one of di defence counsels, Kehinde Eleja, SAN, tell di court say dem no dey ready to immediately file dia defence since dem no dey sure of wetin di ruling go be.

E then pray di court dat di defence counsels go require time to prepare dia defence.

Justice Ojo adjourn di case till 25 April, 2022, for di hearing of di defence.

https://www.instagram.com/p/CapkZd-sSur/

Before now, di lawyers to di defendants for di alleged killing don ask di court to discharge and acquit, dia clients.

Osun state high court bin order di remand of Rahman Adedoyin and six oda pipo wey dey stand trial for di murder of Timothy Adegoke for Ilesa correctional facility.

Di suspects dey face 11 count charge wey dey bother on conspiracy and murder, although all of dem don plead not guilty.

Dem tok say di prosecution neva get any evidence wey connect dia client to any of di 11 count charges wey dem sama for dia head wey bother on murder, conspiracy, felony among odas.

Na on November 7, 2021 di OAU masters student, Timothy Adegoke go missing.

Police later find Adegoke deadi bodi about one week afta dem declare say im dey miss.

Lawyers to di defendants bin tok say all di evidences before di court no dey enough to charge di defendants for di offences.

Otaru bin say “Di only evidence wey di prosecution fit prove be say di 7th defendant na receptionist on duty for Hilton Honour Hotel wia di deceased bin lodge and im also transfer money for di hotel into her account. Dat na di only evidence.

To transfer to her UBA account no be crime, im add say di prosecution don also fail to show say dem suppose charge di defendant.

Who be Timothy Adegoke and wetin happun to am

Before im death, Timothy Adegoke na postgraduate student of Obafemi Awolowo University, Ile Ife.

Di 37-year-old man wey dey live for Abuja bin travel to Ile Ife on November 5, 2021, to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State.

Adegoke family declare am missing afta dem no fit reach am and e no show up for di exam wey e go write for di school.

Police find Adegoke deadi bodi about one week afta dem declare say di man dey miss. Dem arrest di owner of di hotel wia Timothy Adegoke bin lodge before dem declare am missing.

Who be Dr Rahman Adedoyin, one of di suspects for di case?

Dr Rahman Adedoyin na di owner of di hotel, Hilton Resorts wia Adegoke bin lodge.

E be educationist and businessman wey be di founder and proprietor of Oduduwa University and The Polytechnic, Ile-Ife.

Dem born Rahmon Adedoyin into royal family for di ancient city of Ife in Osun State.

Na for Osun state e complete im primary and secondary school education before e proceed to University of Ife (now Obafemi Awolowo University) wia e obtain a Bachelor of Science degree in 1983 afta e study Mathematics Education.

E get im doctorate degree for 1996 from All Saints University School of Medicine, New York City.

E also be fellow of di Nigerian Institute of Industrial Statisticians.

E dey stand trial alongside six odas , Adedeji Adesola, Magdalene Chiefuna, Adeniyi Aderogba, Oluwale Lawrence, Oyetunde Kazeem, Adebayo Kunle, for di murder of Timothy Adegoke.