Di Africans wey win medals for Paris 2024 Paralympics

Fotos of para-athletes wey dey show dia emotions win dm win

Getty Images

Di Paris 2024 Paralympics don come to an end today Sunday 8 September, afta many ogbonge performances by di Para-athletes wey qualify for di competition.

Na di first time wey Paris bin host di Paralympics Games and many see am as ogbonge sporting event.

For dis year Games, na about 4,400 athletes from across di world take part for 22 different sports wia dem compete for 549 gold medals.

Di Paralympic Games wey begin on Wednesday 28 August 2024 wit di opening ceremony bin witness emotional performances by di Para-athletes wey battle dia opponents to win medals.

Howeva, for dis final day of di Games, di closing ceremony and medal events like wheelchair basketball, powerlifting, Para-canoe and also Para-marathon events for athletics happun wia some africans make history.

Nigerian break World Record

Nigeria powerlifter lift her hand for up afta she lift di ova 86kg at di 2024 Paralympics

Getty Images

Nigeria powerlifter Folashade Oluwafemiayo wey compete for di 2024 Paralympics bin set new World Record.

Her feat see Folashade become di first Para-athlete for history to lift 166kg.

She break her World Record for di women ova 86kg Para-Powerlifting to win gold medal for Nigeria.

Wit dis win, Folashade become two-time Paralympic champion and she give Nigeria di seventh medals for di Paralympics 2024.

Team Nigeria bin go all out to give good performance for dis edition of di Paralympics wit seven medals.

Meanwhile, for Tokyo, Nigeria finish for number 33 position for di medal table behind fellow Africans Tunisia, Algeria and Morocco wey dey for 28, 29 and 30 position for table.

But sadly, dis 2024 edition no yield plenti medals as Nigeria end for number 40 position for di medal table.

Di Nigerians wey win medals include:

  • Ugwunwa Flora win silver for Para Athletics Women Javelin Throw,
  • Bolaji Eniola win bronze for Para Badminton Women Singles,
  • Nworgu Esther win silver for Para Powerlifting Women up to 41kg,
  • Mark Onyinyechi win gold for Para Powerlifting Women up to 61kg,
  • Omolayo Bose win silver for Para Powerlifting Women up to 79kg,
  • Olufemiayo Folashade win gold for Para Powerlifting Women ova 86kg,
  • Ogunkunle Isau win bronze for Para Table Tennis Men Singles
Mark Onyinyechi win gold for Nigeria

Getty Images

Who win pass for di 2024 Paralympics?

Afta about 11 days of serious competitions filled wit emotions and energy, China bin top di medal table for di 2024 Paralympics wit total of 220 medals- 94 gold, 76 silver and 50 bronze.

Mhlongo Mpumelelo running wit im mate

Getty Images

Di top 15 kontris wey win big

Oda para-athletes wey win for African kontris

Source