‘Dis na dream come true’ – Reactions as two Ghanaians qualify for di final of Britain’s Got Talent

Two dance sensations from Ghana don react to dia qualification to di final of Britain’s got talent on Thursday night.

Afronitaaa and Abigail Dromo, di hearing impaired seven-year-old, neva fit to hold back dia tears tok say “dis na dream come true”.

“Thank you Ghana for your support. Dis na emotional journey wey we no fit to wait to see wetin go happun next,” Afronitaaa tok.

Di two scatter di stage Thursday night wit dia performance wey feature serious dance choreography from Ghana musician wey dey inside UK, FUSE ODG and Beyoncé.

Dis time FUSE ODG also dey inside di audience togeda wit Afronitaaa and Abigail dia families.

For di second time during auditions, di judges give dem standing ovation as di crowd jam to dia performance from di beginning to di end.

Afta Thursday performance, dem talk say Afronitaaa and Abigail don win di semi-final round of di night by vote, na so dem qualify for di finals on Sunday 2 June 2024.

Musician FUSE ODG tok say im make proud say dem use im song take perform for dis stage.

“As a musician e sweet well-well say I dey inside di audience, na phenomenal performance.”

Im add say, “I dey proud of you guys and you don make Ghana proud”.

Di mama of di 7-year-old dancer don dey overjoyed about im pikin im achievement.

“I make happy pass wey I dey grateful to God for dis. Make Ghana pipo expect something big for di final on Sunday.”

For Ghana, everybody dey hail di two dancers for dia achievement wey dem dey pray say make dem win di final.

Popular YouTuber Wodemaya write for Facebook say “Afronitaaa and Abigail really dey take Africa to di world and making Ghana proud”.

Di Ghana tourism authority tok say make pipo support di two dancers to glory.

“Make we all support dem as dey lift di flag of Ghana high once again. We don dey proud of dem.”

Dis na historic feat as Afronitaaa and Abigail be di first Ghanaian dancers wey reach dis stage for di show.

Di Ghanaian dancers bin trend afta dia amazing performance for Britain’s Got Talent audition wey happun on Saturday, 4 May.

Afta dat performance, di kontri don dey support dem until dia 30 May semi-final performance.

Afronitaaa im former colleagues for DWP Academy wey don rally support for am don write on instagram say dem dey proud of am.

Fellow dancers like Endurance Grand, Lisa Quama and Champion Rollie all hail im achievement.

Dancegod Lloyd also celebrate Afronitaaa and Abigail dia performance for di competition.

Afronitaaa wey be ogbonge dancer and seven year-old Abigail, wey no fit to tok or hear, bin show di judges wetin dance choreography from Ghana dey look like.

For di 2023 finals, Ghetto kids from Uganda bin finish 6th.

Dem miss out on di top three slots.

Di group of six children wey dey between di age of six and thirteen years old bin get one smooth run through di year edition of di highly contested competition till dem reach di grand finale.

For April, di Ghetto Kids gbab news headlines afta dem win golden buzzer for di return of Britain’s Got Talent 2023 competition.

Dem dance on one customized stage to showcase one typical local Ugandan village homestead, di group manage to put on a performance to remember for di semi-finals.

Dia showcase of ogbonge choreography catch di attention of di world and dem continue to cruise through di semi-finals as di first act to reach di finals.

Afronitaaa and Abigail get di chance to make history for Sunday.

Who be Afronitaaa and Abigail?

Afronitaaa na dance artist and choreographer for Ghana wey begin dey dance professionally by di time im dey 14 years.

Im dey part of dance group DWP Academy from 2018 before im decide to leave in 2024 to start im own dance academy for kids.

At 20 years, Afronitaaa don dey pursue business administration for di University of Ghana, wey im dey combine wit dance.

For di six years wey im dey dance, Afronitaaa get ova six million followers across im social media, wia im collaborate wit plenty brands and musicians for Ghana, Nigeria, Tanzania, Barbados, France, Dubai and di UK.

Afronitaaa say im dey “specialise for Afropop wey be mixture of Afrodance wit oda popular dance from oda genres.”

Abigail Adjiri na winner of one talent show for Ghana.

Di dancer win TV3 Talented kids show for August 2023.

Despite say im no dey hear and no fit to tok, Abigail beat competitions for dat show wey im win.

Dem born Abigail with hearing impairment.

But recently, im get hearing aid wey dey fit help am to hear small sounds inside one ear.

But wit im dance talent, Abigail don become national star afta im win di TV3 talent show.

Source