Which kontries get smoking bans, and e dey work?

Woman it’s cigarette

BBC
May 31 na world Jo tobacco day

Na World No Tobacco Day on 31 May and dis year, di World Health Organization (WHO) go focus on ways to try to stop tobacco firms not to target young pipo.

Di WHO dey very effective for dia anti-tobacco campaigns. Most kontries across di world now get measures to check smoking.

Which nations don introduce smoking bans?

Di World Health Organization (WHO) say at least 151 kontries now get laws to check smoking for indoor public places.

E say dis laws dey protect about seven out of evri 10 pipo in di world – 5.6 billion – from di effects of pipo tobacco smoke.

No smoking sign

BBC
More than 150 kontries get laws wey restrict smoking

For 2004, Ireland become di first kontri in di world to ban smoking in public places such as offices, bars, restaurants and on public transport.

Since den, 16 oda nations across di European Union (EU) don pass similar laws – although di EU say some of dia member kontries no dey enforce am strongly.

Evri kontri for South America now don get anti-smoking laws.

for 2006, Uruguay ban smoking for all enclosed public places, and also near hospitals and schools.

Paraguay become di last kontri on di continent to pass national laws against smoking. But since 2020, pipo dia fit only use tobacco products for specific, uncrowded, outdoor spaces.

For 2023, Mexico introduce one of di most strongest anti-smoking laws in di world – wey be ban on smoking in all public places including parks, beaches, hotels, offices and restaurants. Dis one mean say Mexicans no fit smoke anywhere except inside private homes.

From July 2024, tobacco manufacturers for Canada go need to print health warnings on individual cigarettes.

Cigarettes with warning

BBC
After July 2024, evri cigarette for Canada go come with a health warning on am

Di Pan American Health Organisation say nearly a million deaths a year don happen in di Americas, either from smoking or breathing in second-hand smoke.

Wetin don happun to UK smoking ban?

Earlier dis year, di UK goment introduce one radical piece of legislation – di Tobacco and Vapes Bill.

E go make am illegal for England and Wales to sell tobacco products to anybodi wey dem born on or after 1 January 2009.

Scotland and Northern Ireland also dey expected to introduce di same measure.

Currently, di minimum legal age for buying tobacco products like cigarettes for di UK na 18. Di new law go raise am by one year, evriyear, meaning say eventually no-one go dey able to buy dem.

However, di UK Parliament bin dey dissolved in May for a general election wey dem go hold on 4 July, and dat one mean say di bill dey scrapped before dem fit pass am into law.

Di UK bill dey inspired by a law wey dem pass in 2023 for New Zealand, wey similarly don ban di sale of tobacco to pipo wey dem born after di beginning of 2009.

New Zealand law bin dey due to come into force in July 2024, but dem repeal am following a change of goment.

Smoking bans dey work?

Di UK National Institute for Health and Care Research don look at di effects of smoking bans in 21 kontries.

E say e get evidence say dem get reduced rates for heart attack and strokes, and also for bronchitis and asthma.

Girl with inhaler

BBC
Fewer children for UK don go hospital with asthma since dem ban smoking in public places

For 2007, dem extend a ban on smoking in enclosed public places and workplaces throughout di UK.

One report for di British Medical Journal (BMJ) say in di following year, e get 1,200 fewer pipo wey dem admit to hospital for heart attacks dan in di year before.

Following di ban on smoking in public places for Scotland, di number of children wey dey go hospital with asthma drop by almost one-fifth for three years running, according to a study by Glasgow University.

Before dem impose Scotland ban, di number of hospital admissions for children with asthma bin dey increase by 5% a year.

And smoking bans don make many pipo to give up di habit.

According to UK goment data, 22% of adults in di UK for 2006 na smokers. By 2023, only 14% of adults still dey smoke.

WHO say becos of anti-smoking measures taken around di world over di past 15 years, dey fit be about 300 million fewer smokers for di global population dan e odawise for be.

Why WHO dey try to stop tobacco firms to dey target young pipo?

Working from 2022 data, di WHO say worldwide, at least 37 million young pipo aged 13-15 years dey use some form of tobacco. E say for Europe, 11.5% of boys and 10.1% of girls aged 13-15 years na tobacco users.

Di WHO say products such as electronic cigarettes and nicotine pouches dey particularly popular among young pipo. Dem estimate say 12.5% of adolescents for Europe use e-cigarettes for 2022, whereas only 2% of adults do so.

Source