Kizz Daniels twins: Oluwatobiloba Daniel Anidugbe born triplets but one die

Nigerian musician Kizz daniels don reveal say im born triplets but lose one four days later.

Oluwatobiloba Daniel Anidugbe, wey everybody know as Kizz daniels tok dis one for inside social media post.

For di post Kizz daniel say “God bless me wit three boys a while back Jamal, Jalil and Jelani ( triplets).”

“Four days afta Jamal die”. Di singer add as im post scan image of di triplets.

Kizz Daniel also reveal di first gift e buy for im sons. “Congrats to di latest home owners in town , Jelani and Jalil”. e tok.

Dis dey come few months afta im announce di birth of im twins on im birthday for May dis year.

Tori be say for one interview wey Kizz Daniel do wit tori pipo Punch e say im dey like keep im relationship private, even before im become popular.

According to am “I make di decision to keep my relationship private long time ago before I become famous and I don decide to keep am dat way.”

Who be Kizz Daniel?

Kizz Daniel na popular Nigerian musician wey dem born for Abeokuta, Ogun state for May 1, 1994.

Im papa na famous artist and lecturer for Ogun State. Di musician father, Kola, support Kizz dream of becoming a singer, but e also encourage am to complete im education as well.

Na 2014 di singer Kizz release im debut single, Shoye, G-Worldwide Entertainment label.

E release Woju afta shoye wey blow well-well and since then e don go on to produce more hit songs like yeba and Madu just to mention a few.

For 2017, afta di wahala wey im bin get wit im den record label G-Worldwide Entertainment afta dem carry am go court on top songs wey im wan release without di company approval.

E change im name from ‘Kiss Daniels’ to Kizz Daniel.