Schools Resumption in Nigeria: As Waec dey begin 17 August see how Nigerian states dey prepare to reopen schools dis week

Students wey dey prepare to write final exams plus those wey dey exit class go resume school dis week as federal goment don give green light for schools to reopen afta dem close am for March 2020 sake of Covid-19.

Different states for di federation don begin put measures in place to make sure say schools dey safe for students to resume and dey get conditions wey dem don outline for students particularly students wey wan write di West Africa Examination Council.

LAGOS STATE

Before school resumption for final class students, di Lagos state goment don order make dem fumigate all di public schools for di state. Hand sanitizers must dey for inside all di classrooms and hostels and teachers must make sure say students dey sanitize dia hands every time.

Di state goment for dia twitter handle add say schools must enforce social distancing and wearing of face masks dey compulsory.

OGUN STATE

Ogun state goment say Covid- 19 and Malaria test dey compulsory for all SS3 Boarding students.

Di Special Adviser to di govnor on Basic and Secondary Education, Ronke Soyombo post for twitter say one of di criteria for students to enta hostels na make dem submit dis test results and e must be negative.

Na only state approved public health centres dem fit do di test and dem be; Di 250 MTR, Okemosan for Abeokuta, Ogun State General Hospital, Ota and Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital, Sagamu.

Dis requirement bin cause kasala as parents enta street protest say dem dey ask dem to pay N25,000 for di Covid- 19 test.

Di state goment don clear di air on top dis mata say goment go pay di COVID- 19 test money for all di SS3 students wey dey public owned schools.

Private school owners too must make sure say dia boarding students provide certified Covid- 19 test negative result before dem allow dem enta di hostel. Dem fit do di test any wia as far say NCDC don give di Test service provider approval.

Di goment don also begin dey distribute face masks to all schools for di state.

NIGER STATE

Di Niger state commissioner of education Hajiya Hannatu Salihu bin set up 25 Man Committee on school reopening for 21 July

She give di committee seven days to submit dia report.

Afta di 7 days deadline, di committee neva still come up wit full plans according to one press statement wey di ministry of education post for social media but di Chairmo of di committee Mohammed Lemu say im get one small report wey fit serve as guide on top school reopening for di state.

Di Chairman of di Niger State Universal Basic Education Board Isah Adamu say di need to provide personal protective equipment for teachers and students dey important.

RIVERS STATE

For Rivers State, di State Ministry of Education don disinfect many primary and secondary schools as dem dey prepare to resume schools for exit classes, especially for students wey go write di WAEC exams.Di State don also distribute COVID-19 Hygiene kits to all di 257 schools wey WAEC don accredit for di 2020 WAEC exams for di State.

Commissioner for Education, Prof. Kaniye Ebeku add say dem also don set up special taskforce wey go go round to monitor and ensure strict compliance with wearing facemask and oda Covid-19 protocols within di school premises for both teachers and students, come add say;

” We get slogan, ‘Not in my backyard’ to ginger schools for Rivers State to make sure say dem no get any single case of coronavirus for dia schools as we reopen for di WAEC exams.”

ONDO STATE

For Ondo State, local media report say di state goment don begin fumigate all di public schools wey dey di 18 local government areas of di state.

Di Permanent Secretary for di Ministry of Education, Science and Technology, Akin Asaniyan tell tori pipo dis Sunday for inside one of di school wey dem don fumigate say na dis na wetin dem go do for all schools.