Chris Ngige: Bola Tinubu, Hon Faleke vs Minister ‘palava’ –

Chris Ngige, Honourable James Faleke and Asiwaju Bola Ahmed Tinubu drama wey happun on di floor of Nigeria House of Representatives still dey make pipo wonder why.

Tori be say Ngige, Nigeria Minister of Labour and Productivity tell Faleke wey dey represent Ikeja Federal constituency say im dey on di same level wit Tinubu, di National leader of di All Progressives Congress.

E happun say di lawmakers bin invite Ngige make im come tok wetin im know as dem dey torch light why di minister suspend di management of di Nigeria Social Insurance Trust Fund. Di minister accuse di management say dem embezzle 48 billion naira fund.

Why Ngige tell Faleke to respect am like Tinubu

As di House of Representatives Ad Hoc Committee on di Arbitrary Breach of Presidential Directive on di Suspension of Management and Executive Members of NSITF and oda goment Agencies by Ministers begin question am, oga Ngige tell di lawmakers say im senior all of dem.

E change am for Faleke say both of dem no be age mate, say im dey di same level wit Faleke oga, Bola Tinubu.

He say apart from say im and di former Lagos state govnor be age mate, dem get di same political achievements.

Oga Ngige tok say “Faleke dem say you don reach 60, sure you near my age, but I use at least seven years senior you. I dey di same age wit your mentor for Lagos, Aswaju. I be govnor di same time wit am. He be senator, I be senator too. I be minister for two times and im don do minister before”.

Faleke reply, yab am say Tinubu win all im elections well and e no do wuruwuru.

Di minister give am back sharperly say “no problem, just like you win your own election for Kogi State very well. Na only you be deputy govnor and govnor of Kogi state.”

Wen Faleke say make e respond to di questions di committee dey ask am, Ngige tok say I dey respond my friend, if you yab me, I go yab you ten times.

“I be Lagos boy, you na small boy for Lagos. See dis Mushin boy, he dey follow Victoria Island boy tok. See dis Mushin boy from Kogi”.

Many pipo for social media don shook mouth for di mata and hope say e no go turn tribal war.

On top why di lawmakers invite am, Ngige tok say di Nigeria Social Insurance Trust Fund management go get opportunity to clear themselves of di financial fraud wey dem dey accused of.

Oga Ngige tok say im no go contrary to di presidential directive and dat di suspension follow procedure in line wit relevant authorities.

Ngige also accuse di NSITF say dem fail to submit Annual Audited Accounts wey go epp prepare annual reports for Mr President.