Wetin be your right if police arrest you?

Olumuyiwa Adejobi

@Olumuyiwa Adejobi/Twitter
Nigeria Police Force PRO Olumuyiwa Adejobi

Di Nigeria Police Force say na criminal offence to assault, attack or fight police men wey dey carry out dia job to effect arrest.

Di Force Public Relations Officer, Prince Olumuyiwa Adejobi wey give dis informate for inside one video on di Nigeria Police Force verified Twitter account add say di police get right to arrest anybody without warrant.

E say anybody wey assault, attack or fight any law enforcement agent including police wey come effect arrest dey at risk of long jail term.

Dis informate dey come few days afta one video wey go viral show as one popular Nigerian singer, Habeeb Okikiola wey pipo sabi as Portable dey harass police officers wey come arrest am.

Di live video wey trend on social media bin show as di Zazu singer dey try resist arrest afta authority show for im bar for Ifo area of Ogun state Southwest Nigeria.

For di video, di Zazu singer bin make some comment like say police no fit arrest am sake of im be federal gomment liability.

Di police wey condemn di Zazu singer action, say na criminal offence and e dey punishable by di criminal laws of Nigeria.

Portable since don show for di Ogun State Police Command Headquaters for Eleweran, Aboekuta.

Authorities bin arrest am afta di 72-hour ultimatum dem give am to honour di police invitation.

Di state PPRO say as soon as dem conclude investigation, dem go charge Portable go court.

Wetin to do and not to do if police arrest you

Meanwhile, di Force tok-tok pesin, Oga Adejobi say cases of police assault wen dem come make arrest don dey become common for di kontri.

E highlight how pipo go pour hot pepper, cold water on top police body, tear dia uniform, attack dem just because dem come effect arrest. Oga Adejobi say e no dey acceptable and dem no go tolerate am.

Di Nigeria police advice say wen dem or any law enforcement agent invite you and dem show you dia Identity Card;

  • No resist arrest
  • No fight, attack, insult or assault dem
  • Police get right to arrest you even without warrant of arrest
  • Follow dem go di station, answer any questions you fit, if di questions don dey pass your power, you get right to call your lawyer. Na your lawyer go come take up di case wit di authorities.