Three young girls wey die for knife attack plus oda ogbonge stories wey make world headlines for July

Three young girls die for “deadly” knife attack for Southport for one Taylor Swift-themed dance and yoga event.

Police identify dem as six-year-old Bebe King, Elsie Dot Stancombe wey dey seven years, and nine-year-old Alice Dasilva Aguiar.

Eight more children wound and five dey critical condition, afta di incident wey happun late on Monday morning.

Merseyside Police tok say two adults also get critical injuries.

Armed officers detain one male and seize im knife, police later tok say dem don arrest one 17-year-old boy as suspect of murder and attempted murder.

Police believe say a group of children bin dey attend one event for one dance school wen pesin wey dey armed with knife waka enta di building and attack di pipo wey dey inside.

Six-year-old Bebe King and seven-year-old Elsie Dot Stancombe die on Monday, while Alice Dasilva Aguiar, wey dey nine years die for hospital early on Tuesday morning from injuries wey she get from di attack.

Di incident happun for Taylor Swift-themed yoga and dance event for di Merseyside town of Southport, about 10 miles north of Liverpool.

Merseyside Police confam say di armed police “detain one male and seize knife” sake of di incident, and tok say no wider threat to di public.

Di force later tok say na one 17-year-old boy from Banks, Lancashire village to di north of Southport, na im dem arrest on suspicion of murder in connection with di stabbing. Im bin originally come from Cardiff, dem add.

Im still dey for police custody on Tuesday wia dem go ask am questions about di incident, as police dey work to establish di motive for di attack.

Di BBC understand say di teenager, wey we no go fit call im name sake of legal reasons move go di Southport area for 2013.

Im parents na from Rwanda and im get older brother wey dem also born for Cardiff.

Di deadly shootings wey shake America dis week

Police arrest suspected ‘serial killer’ afta dem see plenty deadi bodi for Kenya dumpsite

Why dem no go prosecute six-year-old pikin wey shoot teacher

Di incident happun for Taylor Swift-themed yoga and dance event for di Merseyside town of Southport, about 10 miles north of Liverpool.

Di event bin dey happun for di Hart Space studio, close to one vehicle repair garage, for Hart Street, roughly a mile east of di centre of town.

Di holiday club bin advertise as including a dance and yoga workshop and bracelet making, for primary school children wey dey Year 2-Year 6.

E even dey already fully booked with about 25 children wey dey attend

Di BBC understand say Leanne Lucas, wey dem tink say dey 35 years, bn dey run di holiday club.

Dem no know her condition yet, however pipo don dey pay tributes on social media, to praise her bravery.

For di scene, pipo don drop flowers and teddies for di place wey police cordon, with one message saying: “Fly high with angels little ones.”

Labour MP for Southport Patrick Hurley, wey tell BBC Radio 4 Today programme say di area bin wake up in “shock and grief”, and dem go do vigil on Tuesday evening. Im tok.

Meanwhile Taylor Swift bin post for her Instagram story on Tuesday, she tok say di horror of di attack dey “wash over me continuously”, and say she bin dey “completely in shock”.

“Na just little kids for dance class,” she add. “I dey at a complete loss for how to ever express my sympathies to dis families.”

King Charles III tok on Monday night say e and di Queen dey “profoundly shocked”.

For one statement wey dem post on X, the King say dem send dia “heartfelt condolences, prayers and deepest sympathies” to evribodi wey dey affected by di “appalling attack”.

Di month of July, 2024 generally bin get as e be all over di world.

As di world witness some tragic stories and ogbonge events, from natural disasters to oda violent events wey kill pipo.

Make we chook eye for some of dem.

Landslides for India

Landslide in India

Reuters
Rescuers help residents move to safety

On Tuesday 30 July, landslide happun for southern India state of Kerala.

As at Tuesday, authorities say at least 93 pipo don die and dozens dey trapped afta heavy rains trigger massive landslides for di southern Indian state.

Rescue operations still dey go on.

Landslide for Ethiopia

Rescuers use shovels, hoes to dig through mud wit hope say dem go find survivors

BBC
Rescuers use shovels, hoes to dig through mud wit hope say dem go find survivors

On Sunday and Monday wey be 22nd and 23rd July, Ethiopia record landslide wey kill hundreds of pipo.

Authorities say at least 257 pipo die for di incident

School building collapse for Nigeria

Remains of di school wey collapse for Jos, north central Nigeria

Getty Images
Remains of di school wey collapse for Jos, Plateau State, north-central Nigeria

On Friday 12 July, two-storey school building bin collapse for Jos, Plateau State , north central Nigeria.

Plateau state declare three days mourning, close down school afta 22 pipo including children die for di building collapse.

Di building of Saints Academy wey dey for Busa Buji for Jos North Local Government Area collapse during school hours wen class bin dey go on, dat Friday morning.

Typhoon for China, flooding for Philippines

Typhoon Gaemi

Reuters

On Thursday 25 July, Typhoon Gaemi hit China south-eastern coast state, afta e cause gbege for Taiwan and di Philippines.

China sound highest-level disaster afta heavy rainfall cause heavy oil spill wey kill

three pipo and injure hundreds more.

Meanwhile authorities for di Philippines say at least 21 pipo die sake of flooding and landslides.

Donald Trump survive assasination

Donald Trump

Reuters

On Saturday 13 July one authorities say one teenager Thomas Crooks attempt to assassinate former US President, Donald Trump.

Donald Trump bin dey for rally wen bullet touch im ear as fotos show as blood spill for Trump face.

Aide from Trump wey injure, one pesin die for dat incident and two odas bin injure.

Source