Miss South Africa organisers respond to critics about Chidimma Adetshina qualification to contest

Organisers of Miss South Africa pagaent don tell BBC Pidgin say dem no go make any further comment wey pass wetin dem already tok about criteria for di contest.

Dem also tok say Ms Chidimma too no go make further comment.

Di eligibility of Chidimma Adetshina wey be from Pimville, Soweto, and questions about her nationality begin trend for social media since she enter di stage of last 16.

Some social media users dey ask make dem comot am for di contest sake of say dem feel say she no be South African.

Organisers say all di documents wey Chidimma provide dey screened and vetted.

According to wetin dey di Miss South Africa website, Ms Chidimma Adetshina meet di criteria.

“Di applicant must be South African citizen and get valid South African passport. If di applicant hold dual citizenship, please provide details of both”.

Di organisers further tell BBC Pidgin say ”Chidimma na South African citizen and don meet all di requirements to be part of di Miss South Africa competition”.

“Her mama na South African and her papa na Nigerian”, dem explain.

Miss South Africa 2024 go be di 66th edition of di Miss South Africa pageant.

Di grand finale go hold on Saturday, 10 August 2024 Pretoria.

2023 winner of di beauty contest Natasha Joubert of Gauteng go crown her successor for di end of di programme.

Na di winner go represent South Africa for Miss Universe 2024 pageant wey go hold for Mexico.

‘I wan use my tori to motivate pipo’

Dem born Chidimma Adetshina for Chris Hani Baragwanath Academic Hospital, Soweto, to Nigerian papa and mama of Mozambique descent, and dem raise her for Soweto.

Her parents bin meet for Johannesburg for di late ’90s and decide to settle for Pimville.

Dat na her maternal grand mama home, but she later move to Cape Town wia she dey live currently.

According to wetin Ms Chidimma tok for one interview wit Sowetan SMag, to dey raised for multi-national home don make her see different cultures for di diaspora and how both her origins give her sense of pride as South African.

“I bin dey so happy to enter Miss SA and honestly, I no think dat far as to wetin di public go think”.

But as I bin get to di top 16, dat na wen I feel am she tok for di interview.

“Pipo on X (formally Twitter) bin dey ask why I dey compete sake of I no be South African. Dem bin question my nationality, along wit my parents,” she tok.

“At first I bin ignore am but as I progress for di competition, di criticism bin start to grow by di day. Until I think to myself, I dey represent one kontri but I no feel di love from di pipo I dey represent – I even ask myself, ‘e worth am?’”

For her entry informate, Adetshina say she be law student wey enjoy to play netball for di Western Province.

Di top 13 finalist Chidimma Adetshina for her entry video for di pageant bin tok say she wan use her tori to motivate for unity.

Source