Supreme Court dismiss PDP petition wey question Nigeria vice president-elect candidacy

Kashim Shettima

Getty Images

Supreme Court don dismiss di appeal wey PDP carry come against Vice President-elect Kashim Shettima on di matter wey concern allegations of double nomination.

Court say di appeal lack merit sake of say evidence show say Kashim Shettima withdraw im nomination as Senator for Borno Central Senatorial District.

Inside one letter wey dey addressed to Nigeria election body – di Independent National Electoral Commission, di All Progressives Congress also write to INEC on di withdrawal and substitution of di APC candidate wey show say Ibrahim Massari Kabir voluntarily withdraw im nomination as Vice Presidential candidate.

Di letter also state say APC don nominate Kashim Shettima as di new Vice Presidential candidate of di party. Na for July, 2022 dem write di letters.

PDP wey be Nigeria main opposition party bin dey hope say today judgement, if e favour dem, e go change di hold di ongoing preparation to swear-in di President-elect, Tinubu and e vice, Shettima.

Inside more reason wey dem give, di five-member panel tell di PDP say, one political party no get right to challenge di action of anoda party, or di decision of INEC, in respect of anoda party.

Court also tok say di appellant PDP lack Locus standi to file dis appeal.

Dem explain say for pesin to get locus standi to challenge di nomination process of a political party, di pesin must be neutral pesin and must be an aspirant to that position, and a member of di party.

Di court come rule say Kashim Shettima no “knowingly” allow imsef to dey nominated two times so di section no dey relevant for dis case.

“Di candidate no put imsef up for deliberate double nomination,” na so Justice Adamu Jauro wey read di judgement tok.

Di judge say PDP dey do busy body for wetin no concern dem and para for dem say di attitude of di appellant amount to misleading di court.

Court award two million naira against di appellant wey be di PDP.

Di Supreme Court ruling now don put an end to speculation on if di 29 May inauguration of Tinubu and Shettima go go ahead.

However, di suits by major opposition parties wey dey challenge Tinubu election victory and dia prayers for di Tribunal to nullify di outcome of di election, still dey go on at election petitions tribunal wia hearing go begin on Tuesday May 30, a day afta dem don swear in Tinubu as president.

How di suit against Shettima and APC bin waka

Di mata bin start from di Federal High Court, Abuja under Justice Inyang Ekwo.

Di Federal High Court through Justice Inyang Ekwo bin dismiss di suit on di grounds say di PDP no get di locus standi (di right or capacity to bring any mata or to appear for court) to institute di suit.

Dis judgement no sweet di belle of PDP. as dem no dey satisfied with di judgement dem cari di mata go Court of Appeal, make di Appeal Court torchlight di case.

For di judgement wey di Court of Appeal give, di three-member panel wey Justice James Abundaga lead, hold say di PDP fail to establish say dem get locus standi to institute di case.

Abundaga describe PDP as ‘busybody,’ wey dey shook mouth inside issues wey be in-house matas of APC wey no concern dem at all.

Di Appeal court judge too dismiss di appeal sake of say PDP fail to establish locus standi.

Meanwhile, as many Nigerians dey wait for dis judgement, preparations for 29 May wey dem go swear Bola Tinubu and Kashim Shettima as president and vice president of Nigeria don enta top gear.

For di Conferment of National Honours and Presentation of Transition Documents for State House, Abuja, Nigeria capital on Thursday, President Muhammadu Buhari don already give di National Honours title of Grand Commander of di Order of di Federal Republic, GCFR, to President-elect, Bola Tinubu.

Im also give Vice President-elect, Senator Kashim Shettima, Grand Commander Of di Niger, GCON, title.

Na only presidents and vice presidents dey collect dis ogbonge National Honours.

Di Independent National Electoral Commission, INEC, declare Bola Tinubu and Kashim Shettima as president-elect and vice president-elect of Nigeria afta di 25 February Presidential elections for di kontri.