Kellyrae win Big Brother Naija 2024 season 9 show

33-year-old Kellyrae na di winner of di 2024 edition of di popular TV show Big Brother Naija.

Wanni come first runner up.

Dis year edition of di show wey dem call ‘No loose Guard’ end on Sunday 6 October afta di housemates spend 71 days for di house.

Eight housemates bin be di last men standing – Anita, Kellyrae, Nelly, Onyeka, Ozee, Sooj, Victoria and Wanni.

But di ‘No Loose Guard season’ of di show collect criticisms say e no too bang for Nigeria dis year as pipo no tok about am well-well and e no too trend for social media.

Dis season of di show bin invite di pipo wey compete to come in two by two unlike oda seasons wey na evri man for imself wen dem enta.

Dis one mean say di pipo wey audition for di house bin organise demselves from outside come di house.

In di beginning, e be like di 2019 Double Wahala series wey di contestant bin pair up except for di fact say di pipo wey enta di house already bin come in twos.

Later on sha, dem come separate di pairs so dem go run di remaining parol on dia own.

But how di audience really rate di show dis year? and how e waka?

First make we check-out di pipo wey bin make am in.

Anita

Anita na 28 year old Specialist practitioner.

She bin compete and win di Most Beautiful Girl in Nigeria (MBGN) pageant for 2018.

Di Imo state Indigene enta di house wit her friend Nelly.

Nelly

Nelly bin follow her friend, 2018 MGN winner Anita enta house and na di only pair wey make am to final day.

Di Abia State 29-year-old na chef and entertainer don do video vixen work for ova 100 music videos.

She don work for music videos wit Davido, Burna Boy, Wizkid and odas.

Kellyrae

33-year-old Kellyrae na professional singer wey carry im wife, Kassia follow bodi to enta di house,

Di Delta state singer na last born for im family but tok say im no dey tok again with im siblings afta im mama die.

Onyeka

28-year-old Onyeka na lawyer and entrepreneur wey carry her sister Chizoba enta house.

She like to see herself as one of di best dancers for Nigeria.

Ozee

37-year-old Ozee na lawyer, entertainer and businessman wey come from Imo state.

Im and im twin broda Ocee wey dem follow go di house togeda na di grandpikin of ogbonge Nigerian politician Ozumba Mbadiwe.

Sooj

Sooj na 23-year-old communications specialist from Imo State.

E bin enta di house wit im friend and business partner wey dem dey call Topher.

Victoria

25-year-old Victoria na travel consultant and commercial model from Imo State.

She bin enta di house wit her friend wey dem dey call Shaun.

Wanni

27-year-old Wanni na di second twin wey make am to di final day for house.

Di DJ from Kaduna state bin enta di house wit her twin sister Hanni but na only her still dey house.

Kassia

Kassia na 30-year-old businesswoman wey bin follow her husband enta di house.

She fit make hair and sew but she also dey good at photography, graphics, acting, videography, editing, and making tins like umbrellas, hand fans, bags, and shoes.

Na just last week dem evict am from di house.

Chizoba

31-year-old Chizoba Chigo na software developer wey follow her finalist sister Onyeka enta Big Brother house.

She bin dey evicted for di first solo evictions of di show on 15 September.

Ocee

Ocee na di second Twin for di Mbadiwe Twins. E also be lawyer and entertainer and entrepreneur like im twin Ozee wey follow am come house.

E comot di house on di 1st of October as well as two oda housemates.

Topher

24-year-old Topher na public relations analyst from Akwa Ibom state.

E enta di house wit im friend and business partner, Sooj and comot di house last week.

Shaun

28-year-old Shaun na businessman, model and actor from Edo state.

E follow im friend Victoria enta di house.

E bin comot house for 22 September wit two oda house members.

Handi

27-year-old Handi na also DJ lik her finalist twin Wanni.

She bin comot house wit Shaun and anoda pesin for 22 September.

Beta

29-year-old Ben and im long term friend Tjay enta di house as Beta.

Benjamin Olufemi na club influencer and actor and e come from Delta state. E be one of di first pipo to comot wen dem unpair di two wey enta house.

Meanwhile Tjay, 33, wey be medical doctor from Ogun state maintain steeze till di very next week wen dem comot am.

Di Zinwes

Chinwe and Zion na couple wey bin dey date for six months bifor dem decide to enta di BBNaija house togeda.

30-year-old Chinwe na beauty and skincare businesswoman wey come from Imo state while 26-year-old Zion na model and fashion designer from Edo state.

Di couple bin comot di BBNaija show on di 25th of August as couple.

Di Radicals

Di Radicals dey made up of gym instructor Michky and im friend Fairme David.

Michky na 24-year-old from Delta state while 29-year-old Fairme David na professional dancer and content creator from di same state.

Dem comot di house on di 1st of September togeda.

Flourish

Flourish dey made up of DJ Flo and Rhuthee wey don be friends for ten years from wen dem be schoolmates for Ghana.

DJ Flo, 27 na DJ from Imo State and 32 year old Ruthee na event planner and caterer from Akwa Ibom.

Di team wey dey also call demselves Aki and Paw-Paw bin comot di house on 18 August.

Tami

Tami na bestie team wey dey made up of Damilola and Toyosi wey don be bestie for eight years.

28-year-old Damilola na Nightlife PR manager from Osun State and 26-year-old na from di same state na beautician.

Dem be di first team to comot di Big Brother house for 4 August.

Ndinne

Ndinne na Nne, 22, and Chinne, 31, wey be aunty and niece.

Di two of dem na businesswomen and tok say dia bond grow afta Chinne move in wit Nne mama and papa as Nne say Chinne na like sister to her.

Dem comot di house for di second week of di reality show, even though dem bin dey voted as Heads of House dat week.

Streeze

Streeze dey made up of Toby Forge and Mayor Frosh wey start dia friendship for 2022.

Mayor, 24 na content creator from Oyo state and Toby, 27 na content creator and dance artiste from Ondo State.

Streeze comot di house for 18 August wit di friend group, Flourish.

Why di show be like say e no bang like dat dis year?

Wen Big Brother Naija bin land and up until di all star season of di show for 2023, pipo online bin almost taya on top di tok-tok about di show.

But no be so dis year.

Unlike previous seasons wey di show and di housemates and dia drama dey dominate di trends for social media like X, Instagram and odas, back to back, every week till di show end, nothing like dat dis year.

No be say e no trend at all, but e no strong at all.

Even di fact say di direct descendant of one of Nigeria ogbonge politicians for history, Ozumba Mbadiwe bin dey di show, no ginger pipo to engage.

So wetin fit don cause dis reduced ginger?

Well, e no really dey clear but some critics say na different factors fit don affect di show dis year.

Every year, criticisms bin dey always come from some quarters about di role of di show for nation building, but di show popularity especially among di youths bin dey drown am out.

But dis year, just three days afta di start of di 9th season of di Big Brother Naija show, di kontri go on nationwide protests wey dem call End Bad Governance, to protest di state of di economy for di kontri wey show imself in di high cost of living, food price and fuel price.

As di protests bin dey pre-planned and dem announce am at least a month bifor e start, pipo for social media start to dey reason am as distraction so young pipo no go protest.

So di timing of di show fit be one factor.

E fit also be di format of di show dis year, some critics tok say di style wey make dem come in pairs fit also no work for di show dis year.

Anoda reason fit be say pipo fit just don taya, as simple as dat.

Wetin Big Brother Naija dey all about?

Big Brother Naija na reality show wey don run for nine seasons now.

Di show set up be say pipo go dey inside one house and no go fit go anywia, and dem go live stream di lives inside di house for entertainment.

E also get games and wagers plus contest for Head of House wey dey ginger di contestants to shake bodi.

Over di years, many Nigerians don criticise di show and many continue to see di show as “distraction” and something wey no dey add value to di society.

In 2019, one Islamic human rights organisation, di Muslim Rights Concern, Muric bin ask di Federal goment of Nigeria to ban di show.

Muric Director, Prof. Ishaq Akintola bin describe di show as ”abomination”, ”exhibition of nudity” and ”invitation to chaos and insecurity” becos e dey allegedly mislead di young pipo.

Fans of di show most times no dey mind wetin oda pipo dey tok about am as di show dey always carry on despite di condemnation.

For di 2023 general election for Nigeria, pipo bin dey caution di young pipo, make dem no allow di show distract dem.

E dey debatable weda or not di show don ‘distract’ anybody as some believe but young pipo wey don appear for di reality TV show don also see am as opportunity to live dia dream, as di show dey give platforms to winners and oda popular housemates to come out from di show, and leverage on dat exposure grow dia careers.

Especially for Nigeria wey di number of unemployed youths dey high.

Source