Ghana court grant Ama Governor, 8 odas bail

Di high court for Ghana don grant bail to lawyer Ama Governor and 8 oda protesters wia police don arrest on 22 September during one demonstration against illegal gold mining.

Di police bin charge dem wit conspiracy to commit crime, unlawful assembly, destruction of public property and assault of public officer.

Di pipo don deny di claims wey dey plead not guilty; na so di circuit court deny dem bail on 25 September wia e remand dem inside prison and police cells.

Since den, ogbonge human rights groups and oda pipo condemn di detention of di protesters for more than 12 days.

Amnesty international tok say na “abuse of dia rights”, dia lawyers also tok say police don treat dem any how as dem dey for cells and prison.

According to dia lawyers, di police don deny some of dem access to dia lawyers, food, water and sanitary materials for di women.

Last week, young pipo for di kontri stage 3-day protest to demand say make di state free di 53 pipo wey dey arrest.

Dey also continue dia protest against illegal gold mining (galamsey) wey destroy all di kontries rivers and forest reserves.

On 5 October, di president of Ghana, Nana Akufo-Addo don grant interview to France 24 wey im tok say e no be im give order say make dey arrest di protesters.

“I no dey responsible for jailing pipo for Ghana, na di courts wey be independent institutions since di fourth republic, dey do dia work.”

Im tok say “pipo don misconduct diaserf wey dey take dem go court, na di court gat to deal wit dem, dis no get anytin to do wit di executive.”

Nana Akufo-Addo add say “na di behaviour of di protesters land dem inside problem wit di police and di court, e neva be sake of dia protest.”

“How say a president wey my political career happun sake of protests go get problem wit protests? I neva get problem wit protests and for Ghana we neva dey prevent pipo say make dey no talk dia mind on any mata.”

Pipo don sama di president well well, say im dey use di security services to prevent free speech and demonstrations.

Na so on Monday 7 October, one high court don grant 9 of di protesters bail.

Di court wia Comfort Tasiameh dey preside, grant di 9, bail for di sum of ¢70,000 cedis ($4,400) wit 2 sureties.

Di court tok say di pipo go report to di police once every week wia dey gat to present dia Ghana card.

Apart from lawyer Ama Governor, di oda 8 na Emmanuel Gyan, Emmanuel Kwabena Addo, Ziblim Yakubu, Oheneba Prempeh, Philip Owusu Kwabena, Akisibik Desmond, Von Coffie, and Sadik Yakubu.

During di hearing, lawyers for di protesters bin argue say di protest wia di pipo do on 21-23 September, na peaceful protest wia dey against di destruction of di environment by illegal gold mining.

Im argue say di protest neva be about violence.

Di judge don recognize say di protesters get right to demonstrate wey di police gat to also ensure law and order during dis kind demonstrations.

Di high court currently dey hear bail application for anoda 12 wey include lead activist Oliver Barker-Vormawor.

Oliver Barker-Vormawor denied bail again

Di High court for Ghana reject bail application for lead activist for anti-illegal mining demonstration, Oliver Barker-Vormawor once again.

Oliver and 52 odas bin dey bifor di court for various charges wia di police put on top dia head including stealing, conspiracy to commit crime, unlawful assembly, destruction of public property and assault on public officer.

Lawyers for lead activist and oda leaders of di democracy hub bin argue for court say make dey grant dem bail sake of dey no dey pose any risk, wia dey go dey available for trial.

But di court deny Oliver bail.

Presiding judge tok say im no go grant am bail sake of im already dey stand trial for one treason mata.

Justice Srem-Sai wia be lawyer for Oliver tok say im client no fit to run away sake of im dey available dey stand trial for treason, no be misdemeanor charge wia go make im run away.

But di judge explain say di concern na whether Oliver go commit anoda offense if dey grant am bail.

For dat reason, di judge don deny di social activist bail, wia im give some orders.

Di high court don order say make di circuit court wia remand Oliver and di odas, immediately begin trial of di mata within 72 hours.

Source