Local government chairmen for Rivers state go fit enta dia office?

Rivers LG Council Chairmen taking oath of office

RSGH Media
Governor Siminialayi Fubara swear in di LG Council chairmen on Sunday 6 October, 2024

Some jaguda pipo don go set fire on some council secretariats and pursue di newly sworn in council chairmen wey go resume work.

Dis dey follow di withdrawal of police from di local goment Council secretariats for Rivers state.

Tori be say council secretariats for Ikwerre, Eleme, Obio/Akpor and Emohua dey set on fire while alleged loyalist of di FCT Minister Nyesom Wike don take over di council secretariats for Ahoada West LGA, while one pesin dey feared dead for Ahoada East LGA.

Local goment chairmen don resume peacefully for oda local goment council secretariats and swear in legislative assembly members for di various councils before dis incidents begin happen.

Govnor Siminalayi Fubara bin swear-in di 23 newly elected Chairmen afta di presentation of certificates of return to dem.

Dis na afta di local goment election wey hold across di state on Saturday.

Police never tok anytin about dis latest incidents wey don happen but police authorities bin order di immediate withdrawal of all officers from di council.

Police bin mount for all di council secretariats at di height of di political crisis for Rivers state in June.

Tok-tok pesin of di police SP Grace Iringe-Koko for statement say na di police IG give di order for di officers to comot.

“In view of di recent political developments in Rivers State, di newly deployed Commissioner of Police, CP Bala Mustapha don convey di directives of di Inspector General of Police, IGP Kayode Egbetokun, for di immediate withdrawal of all police personnel previously deployed to seal and safeguard di Local Government Secretariats in di state,” di statement tok.

Iringo-Koko add for di statement say, “dis decision dey in line wit di commitment of di Nigeria Police Force to ensure neutrality and di smooth functioning of democratic institutions.

“Consequently, di IGP don order di unsealing of di Local government secretariats, wey bin earlier dey secured by police personnel.”

“Di police go only dey redeployed to dis locations in di event of any crisis or breakdown of law and order, in which case emergency measures go dey implemented to restore normalcy.”

Rivers Council chairmen taking oath of office

RSGH Media
Di 23 Newly elected council chairmen take dia oath of office for Government House on Sunday 6 October 2024

Di Action Peoples Party (APP) win 22 chairmanship positions out of di 23 councils for di Rivers State council polls.

Na di chief election officer of di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC), Justice Adolphus Enebeli rtd make di declaration on Saturday for Port Harcourt.

Dis na di first time opposition party go win council election for di state since 1999 – bifor now na di ruling party for di state dey always win am.

Candidate of Action Alliance, Uzodinma Nwafor na im win di chairmanship election for Etche local government council.

Di names of di Local Goment Chairmen wey di Governor swear-in na: Vincent Obu – Abua/Odual, Chibudom Ezu -Ahoada-East, Iyekor Ikporo – Ahoada-West, Tonye Oniyide – Akuku-Toru, Lazarus Nteogwuile – Andoni, Sule Amachree – Asari-Toru, Anengi Barasua – Bonny, Harry Agiriye – Degema and Brain Gokpa – Eleme.

Odas na David Omereji – Emohua, Monday Dumiye – Gokana, Isreal Abosi – Ikwerre, Martins Nwigbo – Khana, Chijioke Ihunwo – Obio/Akpor, Prince Isaac Umejuru – Ogba-Egbema-Ndoni, Ishmael Oforibika – Ogu/Bolo, Dr Igwe Achese (APP) – Okrika and Promise Reginald – Omuma.

Di remaining na Enyiada Cookey-Gam – Opobo/Nkoro, Gift Okere – Oyigbo, Ezebunwo Ichemati – Port Harcourt and Matthew Nenubari Dike – Tai.

Atiku, PDP govnors hail Fubara ‘courage’

Bauchi State Governor in Rivers Govt House

RSGH Media
Bauchi State Governor and Chairman of PDP Governors Forum Bala Mohammed witness di swearing in ceremony

Di ruling party for di state, Peoples Democratic Party no involve for di election. However, some leaders of di party hail govnor Fubara say e fit do di election despite all di political kasala for di state.

Former Vice-President Atiku Abubakar say di outcome of di local goment elections in Rivers na a rejection of political oppression and godfatherism in di state.

Di PDP structure for Rivers State dey believed to dey controlled by Wike, Fubara predecessor and former ally.

Wike bin back Fubara to win di 2023 governorship election but di both politicians get kwanta just one year later.

For statement wey dem issue on Sunday, Atiku — wey bin don get problem wit Wike ahead of di 2023 general election — say di conclusion of di LG polls don pave way for di pursuit of democratic governance to begin for di state.

“Wit di conclusion of di local goment election in Rivers state, di shadows of political intimidation and judicial chicanery don destroy, paving di way for di noble pursuit of governance to commence in di state,” e tok.

Bauchi State Governor and Chairman of di PDP Governors forum, Bala Mohammed during di swearing-in ceremony say na PDP dey run di state but no be di party dey control am.

E say govnor Fubara na di vice chairman of di PDP Governors forum and e still dey wit dem despite all di kasala wey dey happun.

“Dis na di problem wey we don find ourselves inside as a party and as governors,” oga Mohammed tok.

Di PDP govnors forum chairman say di conduct of di local goment elections na good sign.

“Im no get di structure of di Party for di State for a reason and e gatz go out to make sure say e allow oda parties to participate within di political space. I dey very proud of Fubara.”

“Im don establish imsef as a govnor and di pride of all di govnors of Nigeria,” Bauchi state govnor tok.

Govnor Fubara charge di newly sworn-in chairmen to ensure say dem remain connected wit di pipo for dia council areas and emulate im approach to peace so dat dem go dey more patient with pipo and di situation without being violent.

E add say im dey aware say im detractors dey mobilise 20 pipo per political unit, wit instructions to attack dem wen dem report to dia various council secretariats to resume duties.

Source