Dubai flood sotay dem divert planes from di busiest airport for di world

Pipo dey move car wey don hook inside flood water afta heavy rain fall for di Dubai Sports City district of Dubai, United Arab Emirates

Getty Images

Heavy rains don knack some Gulf states wey cause flash flooding around di region and make dem divert flights wey bin dey enta di world’s busiest airport.

Dubai Airport bin tok say, operations bin dey “temporarily diverted” even though dem don start again.

Authorities say at least 18 pipo don die for di floods.

For plenti states, di rains wey sama dem in one day na di rain wey fit take almost one full year to fall.

Unverified video wey comot from Dubai International Airport show wetin be like jets wey dey take off for flooded runways dey move and create waves wit di water.

Heavy rain don cause flash flooding for di UAE city of Dubai
The British Broadcasting Corporation

For statement, di airport say incoming flights wey suppose land on Tuesday evening bin dey diverted “sake of di ogbonge continued weather event wey dey currently happun for di UAE”.

E add say departures go continue. Flights bin later start again afta two hours delay.

On Tuesday morning, di UAE National Centre of Meteorology comot wit weather warning for large parts of di kontri wey include Abu Dhabi, Dubai and Sharjah.

Di Gulf region dey very popular as place wey dey hot and dry, even though for recent years, heavy rain wey dey cause flooding don dey more common.

Motor spoil afta one side of di road collapse for di Dubai Sports City district of Dubai sake of heavy rain

Getty Images
Motor spoil afta one side of di road collapse for di Dubai Sports City district of Dubai sake of heavy rain

For neighbouring Oman, authorities say di death toll from flash flooding don increase to 18 and dem still dey find some pipo.

Di number of dead pipo include 10 students wey dey between di age of 10 and 15 wey die on 14 April wen di motor dem bin dey inside bin wan try cross one flooded area, but water carry am go.

For Bahrain, video show cars wey hook for flooded roads.

Motor dey parked for flooded parking lot afta ogbonge rain fall for di Gulf Emirate of Dubai

Getty Images

Scientists don link di unusual weather to climate change, say ogbonge storms go start to dey more common for future as di planet dey warm dey go.

For evri 1C rise for average temperature, di atmosphere go fit carry around 7% more moisture. Dis fit cause more droplets and heavier rain to fall, and sometimes e go fall in less time and for smaller area.

Di UAE, wey be one of di biggest oil producers for world, bin host di COP28 climate change conference last year.

Driver dey wait as e dey try drive for flooded road for di Dubai Sports City district of Dubai

Getty Images

Source