Cases of missing manhood hit Ghana

Cases of missing manhood hit Ghana

Getty Images
Police don dey search oda pipo wey dey spread rumour say dia penis vanish

For di past two weeks, pipo don dey raise alarm for parts of Ghana say dia gbola dey disappear.

According to dem, dia manhood disappear afta some pipo touch dem for street or market.

For some viral videos for social media, some pipo for areas like Kasoa and Madina, don complain for di mata.

Na so some residents begin to dey attack pipo wey chop accuse say dem cause pipo dia manhood to dey disappear.

Inside one video, pipo gather wey dem dey slap one young man to confess say im cause pipo dia manhood to vanish.

Alreadi, Kasoa na area wey dey notorious for many crimes.

As pipo don dey complain about dia missing manhood for dia, na so odas start to fear.

Afta di mata begin to for social media, di Ewutu Senya municipal assembly don tok say di mata neva true.

For one statement, dem tok say dem no get any medical evidence say pipo dia manhood dey disappear for di neighbourhood.

Dem tok say “di rumour say some ritualists dey pipo dia manhood to vanish afta dem touch dem for di area, na lie.”

“No medical team for dis assembly fit to confirm dis mata, make pipo no believe di rumours.”

Despite say di assembly dismiss di allegations, pipo still dey attack odas for town say dem cause dia manhood to vanish.

Police arrest nine pipo ova false alarm

Nine pipo dey inside di grips of di police ova di false alarm dem create about dia manhood.

Di police tok say dem arrest dem across di kontri for causing “fear and panic among di public and attack on innocent citizens.”

Di statement by di police tok say “investigations and medical examination don show say all di claims of vanishing manhood na false.”

So far, out of di nine pipo, six, dey Kasoa for di central region, two dey inside Ashaiman for Accra and one pesin dey Nkawkaw for di eastern region.

Police don arraign five of dem wey dem remand three for police custody wit two, on bail.

Di rest dey on police inquiry bail wey dem go soon dey arraigned.

Di police tok say di trend wey pipo go make “dis false claims say dia manhood vanish and blame innocent bystanders wey dey cause mob attacks, na bad thing.”

Dem tok say “dis na criminal act wey go fit harm innocent pipo and disturb di public peace.”

Wetin fit cause dis feeling say your manhood disappear

One sabi pesin for di Korlebu teaching hospital tok local media station TV3, say dis tin fit to be “stress-induced psychological issue.”

Specialist psychiatrist, Dr Albert Sedohia tok say research don show say it fit to happun every 5-10 years wey im neva be for Ghana alone.

“Dis pipo fit dey under some stress, na so dem also fit experience physical or psychological arousal.”

Im add say for some cases, pipo fit report say dia manhood don shrink but las las im dey return to normal.

Im tok say “pesin no fit to touch anoda pesin physically wey im manhood to vanish, na psychological mata.”

Source