Arsenal vs Bayern, Real Madrid vs Man City, Champions League predictions

Split picture of Harry Kane, Kyle Walker, Jude Bellingham and Bukayo Saka

Getty Images

Di quarterfinal round for dis season Champions League go kick off dis week wit some ogbonge matches.

On Tuesday Arsenal go play German champions Bayern Munich wey now get former Tottenham striker Harry Kane, while holders Manchester City go jam Real Madrid for a repeat of di 2022 and 2023 semi-finals.

Who go get upper hand for dis games? na one of di big kwesion wey dey worry fans for mind.

Di oda ones na, if Real Madrid Jude Bellingham go shine pass Man City Rodri? Or if di Gunners go be dis season surprise team?

We go torchlight dis matches and our football sabi pesin go predict di results.

Arsenal vs Bayern Munich preview

Dis na di first time wey Arsenal dey reach dis stage of di competition since 2010, and dem dey face di same team wey bin end dia campaign again.

Bayern don win seven out of di 12 matches wey di team don play including di last three all na wit 5-1 scoreline, e go be big achievement if dem repeat dat kain performance again on dis current Gunners team.

Mikel Arteta team dey score well-well dis year for home and for Europe, although na penalties dem use win Porto for round of 16.

While for Bayern dem been beat Lazio 3-1 on aggregate for dat stage to reach a record 22nd Champions League quarter-final but dem need to play better pass dia first-leg display for dat tie, wen dem chop beating for Rome.

Date, kick-off time and venue

Arsenal vs Bayern Munich go kick-off by 9pm West African time on Tuesday, April 9, 2024.

Di match go take place for Emirates Stadium.

Arsenal vs Bayern Munich prediction

‘’Bayern Munich fit beat Arsenal home and away.’’ Na wetin Gift George football sabi pesin tell BBC Pidgin.

‘’I tok so based on dia Champions League experience and dia coach Thomas Tuchel wey sabi play dis competition well- well’’, George Add.

But e no easy for di German side based on dia current form especially now wey di Bundesliga title no day dia hand again.

On current form, Arsenal go win becos dem don improve dia defensive game wey bin dey worry dem before.

Prediction: 1-1

Form guide

Arsenal

Form (all competitions, most recent first): WWDWWW

Recent result: Brighton 0-3 Arsenal, 06/04, English Premier League

Bayern

Form (all competitions, most recent first): LLWWWD

Recent result: Heidenheim 3-2 Bayern, 06/04, German Bundesliga

Wetin di coaches tok?

Champions League quarter finals

Getty Images

Edu, Arsenal sporting director Uefa say: “Na beautiful game to play. We go play against a team wey dey very experienced for dis competition and dem get correct players, but we get good momentum. We dey really gingered to face dem and see if we fit go through.”

Thomas Tuchel, Bayern coach: “For sure we get di most difficult road imaginable ahead of us – now to play against one of di best teams for Europe. For two years now, na im Arsenal don dey playing consistently at di top. Dem be, dangerous team, dem dey score plenty goals. But we go dey prepared for am. We know our qualities.”

Real Madrid vs Man City preview

Los Blancos bin dey dominate Europe for di past decade but dem chop 4-0 defeat for Etihad Stadium for last year semi-final.

Carlo Ancelotti side bin look ordinary as City collect dia first Champions League title for dia history.

Di arrival of Jude Bellingham don help di Spanish team well-well, di English player don score many goals since im make di move from Bundesliga to La Liga

Ahead of dis game Madrid get a nine-day break.

Meanwhile Guardiola bin dey complain about di tight schedule for im team.

City also dey eye Premier League title wit Arsenal and Liverpool.

Date, kick-off time and venue

Date, kick-off time and venue

Real Madrid vs Man City go kick off by 8pm West African time on Tuesday 9 April, 2024.

Na di Santiago Bernabeu for Madrid dem go play di first leg.

Real Madrid vs Man City prediction

‘’Manchester City go scale through again if everybody dey fit, just for two reasons one Madrid get di best team for Europe but dis kain game individual brilliance go make di difference’’, George tok .

‘’Carlo Ancellotti side go rely on Vinicius junior and Rodrygo but dem no get experienced striker, dis na wia Man City go win am for me’’, George add.

George believe say City Squad strong pass Real Madrid own.

De Bruyne, Rodri, Phil Foden, Alvarez, Halland all fit score while Doku fit come from bench to add quality..

Prediction: 1-1

Meanwhile dis na wetin Real Madrid boss Carlo Ancelotti tok about di match against Manchester City:

“Di most important tin na to put in a great performance. Our mentality go dey very important, di kain personality we show for pitch go also dey key.

“We get enough time to prepare for dis game and I feel say we go do a good job – I get great confidence in my players and I feel say dem go do dia best in all aspects, mentally, physically and technically.

“We get enough quality to compete well-well tomorrow.”

Source