Timeline of Rwanda genocide 30 years later

Timeline of Rwanda genocide 30 years later

Getty Images

Rwanda president say di international community “fail all of us”, as e mark 30 years since di 1994 genocide wey kill around 800,000 pipo.

President Paul Kagame tok dis one as e address dignitaries and world leaders wey gada for Rwanda capital, Kigali, to remember di bloodshed.

“Rwanda dey completely humbled by di magnitude of our loss,” e tok.

“And di lessons wey we learn dey engraved in blood.”

On dis day in 1994, extremists from di Hutu ethnic group launch 100-day killing spree, wey members of di Tutsi minority and Hutu pipo dey slaughtered.

Source