How Nollywood mourn di death of Adejumoke Aderounmu wey die at di age of 40

Popular Nollywood actress Funke Akindele don join oda Nigerian celebrities to mourn di death of dia colleague, Adejumoke Aderounmu.

Funke Akindele share di foto wey confam di death of di actress for her Instagram story.

Na one of her family member, Adeola Aderounmu confam her death on one post for im Instagram story.

E post say “You dey for beta place now my sister”.

Madam Aderounmu wey pipo sabi well-well as Esther sake of her role for one popular television series Jenifa’s Diary die on 6 April at di age of 40.

Di cause of her death neva dey known. However, according to di family member post, dem don hold one funeral service for Aderounmu Adejumoke for Owu Baptist Church, Totoro area of Abeokuta for Ogun State.

Di actress gain popularity for 2016 afta she feature for Jenifa’s Diary.

Bifor den, she bin work as on-air personality for Goldmyne Entertainment Box Office as TV show presenter. She bin also work for radio station from 2012 until 2015.

For 2012, she produce di first season of her TV show, The Lounge wit Jumoke, one entertainment show wey feature celebrity interviews and fashion opinions.

She bin act oda movies wey include Arugba, Industreet, Gone, among odas.

Nollywood actors such as Mary Njoku, Jide Awobona, Rita Edochie, Wunmi Toriola don express sadness to di tori of her death.

Her death dey come as di Nollywood industry still dey mourn di death of Mr Ibu, Amaechi Muonagor and Sisi Quadri.

Source