Ammonium nitrate blast na im cause Beirut Lebanon explosion for port – Wetin dis chemical compound wey explode like bomb be dey here

Lebanon dey mourn afta one huge explosion inside di capital Beirut kill at least 78 pipo and injured more than 4,000 odas on Tuesday.

Di whole of Beirut city shake gbim-gbim-gbim sake of di blast, wey begin wit fire for di port wey later come explode into thick cloud.

President Michel Aoun say na 2,750 tonnes of ammonium nitrate wey dem be store unsafely inside one warehouse for six years cause di Lebanon explosion in Beirut.

Wetin be ammonium nitrate?

Ammonium nitrate get a number of different uses, but di two most common na say dem dey use am as an agricultural fertiliser and as an explosive.

E dey highly explosive wen e come into contact wit fire – and wen e explode, ammonium nitrate fit release toxic gase including nitrogen oxides and ammonia gas.

Contains scenes which some viewers may find upsetting. – “Now I’m shaking, all the way from up to down” – Eyewitnesses describe the power of the explosion
The British Broadcasting Corporation

Because e dey so easy to ctch fire alias flammable, e get strict rules on how to store ammonium nitrate safely – among di requirements na say di storage site needs to be thoroughly fire-proof, and notin like drains, pipes or oda channels in which ammonium nitrate fit build up, because e go create additional explosion hazard.

Beirut blast

Reuters
Ammonium nitrate explosion can release toxic gases