From 187 to 1,100 naira in one year – Nigerians lament high rising price of fuel, expert say ‘expect more’

Nigerians dey struggle for fuel

BBC

Di recent increase in di price of premium motor spirits PMS don dey get affect.

Many Nigerians shock wen dem hear say goment don increase price of fuel on Wednesday.

Dis na di third time for 2024 wey price of fuel dey go up. Many filling stations dey closed for di oil rich city of Port Harcourt di Rivers State capital for southern Nigeria.

For Abuja, anger and sadness dey written for di faces of motorists, keke operators and okada riders wey don dey for fuel queue for more dan three hours on Thursday morning to buy petrol for di NNPC station for Nyanya.

Nyanya na di suburb of di Federal Capital territory wey dey for di border wit Nasarawa State and na majorly middle and low-income earners dey live dia.

One female taxi driver just dey lament give BBC Pidgin tori pesin on how she don dey for di petrol queue and miss her normal morning rush business.

“You know say dis taxi business get time, now di morning business don pass and I still dey for queue.

“If evening come now you no go do up to three trips bifor you gatz come stand for queue again to buy fuel. Wen dis suffer head go end?” di woman wey dey too angry to tok her name ask.

“Na only 9,000 fuel I wan buy and e no go even reach nine litres, money wey be say before dem remove fuel subsidy e fit buy me more dan half tank,” she lament.

Many private fuel stations for Abuja no dey open for business wen our tori pesin check. For neighbouring Nasarawa State, pipo bin don dey buy petrol for more dan 1000 naira.

One military man for di queue wey no dey on uniform tok say e bin dey cost am about 80,000 naira ($47) to fill im tank “but now e dey 100,000 ($50) to fill my tank now. How pesin go fit cope?”

“Dis Christmas go tough o. Me wey I bin dey think to travel to Lagos, I just dey wonder how dat plan go still get head,” e tok

Di few filling stations wey dey sell put dia prices between 1,350 to 1,650 naira (1$) per litre while NNPC filling stations for Port Harcourt dey sell at 1,065 per litre from N996.

Wit fewer vehicles on di road, di impact of di recent increment still dey felt in transport fares wey don increase from 150 naira per drop to between 200 to 300 naira per drop.

Marketers say make pipo prepare for further increases becos dem go still increase di price of di products accordingly.

Dr Joseph Obele wey be energy expert say di new buying rate for marketers within Port Harcourt catchment area now na 1,045 naira per litre as against di rate of 876 naira bifor now, while marketers for Lagos go now buy at a new rate 1010 naira per litre.

“E important for di general public to understand say marketers buying rate dey different from marketers selling rate for filling stations,” e tok.

Di high cost of fuel make many keke drivers for Kano state, Northwest Nigeria tok say dem no dey make gain sake of fuel price wey bin increase.

While odas wey depend on transport business in Kano, pipo also abandon dia jobs sake of dem no dey get enof gain wey dem fit deliver to di owners of Keke.

Yakubu wey say e bin dey do keke business for many years decide to quit im job sake of e want to avoid problems wit im oga becos e fit deliver beta money.

“I stop dey do keke becos I no want any problem wit my oga sake of profit no dey again like di way e dey befor fuel dey cost like dis”

“Befor na 1,300 naira I dey use full my tank wey no I go need to spend 9,000 naira or more for me to full my tank”

“For everiday I suppose to dey give my oga 6000 ($7) wey dey veri hard becos of fuel price don increase”

“Di situation dey make us drag wit passengers wey sometimes dey cause problems for us, na wetin make I stop.”

Anoda keke driver for Kano Yusuf tok say dem dey disappointed on how goment dey increase fuel price.

“I dey veri disappointed becos now e mean say we just dey drive keke to get something we fit feed our family becos we no dey make any good profit,” Yusuf tok.

Nigerians dey struggle to buy fuel

BBC

Di Ex-depot price na di rate wey marketers dey buy from NNPC, afta which dem go add a mark-up based on over head expenses and operating costs.”

Dr Joseph, di energy expert say di new fuel increment fit dey triggered by di withdrawal of NNPC as middleman from Dangote Refinery supply chain.

E say NNPC decision to end dia exclusive purchasing agreement with Dangote Refinery go allow oda marketers to buy petrol directly, and dis go promote a more deregulated market.

But e imply say di national oil company no go cover di price gap between di facility price and di selling price to retailers, as dem bin dey absorb a subsidy of N133 per litre.

“Regrettably, di new increment of PMS go further worsen di bitting inflation in Nigeria as prices of oda commodities go definitely experience upward review in coming days.”

Above all, majority of Petroleum marketers go go out of business and sack workers for inability to raise di recent capital for purchasing one truck of PMS.

As at last year, a truck of 45000 litres of PMS na 7 million ($4,300) only. Arising from di recent increment, a truck of PMS fit now cost about 47 million naira ($28,000)

Di inability of marketers to raise capital due to di recent increment go fit make many marketers quit business, wey go lead to sack over one million direct and indirect Staff.” E tok.

Source