NDLEA dey demand married women to bring letter of approval from husband to get visa clearance?

One 30-year-old male drug addict dey prepare to shoot heroin for one Kawangware slum for Nairobi, Kenya

Getty Images

Nigerians don para tire for social media on top one misinformation say di kontri drug police, di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, dey demand make married women wey wan apply for visa clearance, bring approval letter from dia husbands.

Earlier, tori bin appear for some blogs and local media for di kontri say di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) mandate married women to bring letter of approval from dia husbands.

Many pipo bin see dis requirement as discrimination against women as dem para say di agency no make di same demand on di husbands make dem bring approval letter from dia wife.

But NDLEA tok tok pesin, Femi Babafemi, tell BBC say, dis na case of misinformation as dis policy bin don dey ground for some years now, sotey dem don even stop am since di last one year.

E say dis requirement for letter of approval from husband bin no dey among wetin dem bin require, until less dan 10 years ago wen some married women chop arrest for some Asian kontris for drug trafficking.

As a result, di NDLEA tok tok pesin say, di affected kontris decide to include di particular requirement for wetin agency need to clear dem for visa, as temporary measure.

“Dis requirement no be NDLEA requirement, na di source kontris say dem want am like dis,” im tok.

Babafemi say right now, wetin di agency dey do na di review of im entire procedure for visa clearance for di kontri pipo wey need di document to apply for visa.

Why NDLEA dey review di clearance procedure

Di agency say dem wan review di whole process wey Nigerians go follow to applying for clearance visa to make everytin digital.

Na inside dis process dem plan to officially scrap di need for married women to bring approval letter from dia husband, even though before now, e no dey mandatory again.

Wit di new digital platform wey dem go setup for dis purpose, even Nigerians wey dey live abroad go fit apply for and get di document without travelling back to Nigeria to get am.

Wetin be visa clearance?

NDLEA visa clearance certificate dey give proof say, dem don investigate you, confam say you no get any record related to drug trafficking offence for Nigeria.

Na di source kontri, or di kontri wey you wan travel go, na im dey dey usually request for di document.

According to di agency, na eight kontris na im dem dey obligated to provide visa clearance for, dem include Thailand, Malaysia, Indonesia, India, Brazil, Pakistan, the Philippines, and Russia, plus odas.

All dis kontis get very strict drug trafficking laws wey dey result in life imprisonment or death.

Dis one mean say, if you as Nigeria pesin wan apply for visa to go any of dis kontri, you must to first go NDLEA apply for dis document, afta dat, you go carry am go dis kontris embassy wit you oda documents.

Babafemi say dis eight embassies value visa clearance certificate pass anoda certificate wey a Nigerian wan take apply for visa.

E say dat na why im agency dey do thorough background check and verification of every informate wey pipo put for dia application form to get di clearance.

Source