Niger, Mali and Burkina Faso wan join force to fight jihadists

Rally in support of di Alliance Sahel States, Bamako, Mali - 01 Feb 2024

EPA

Niger, Mali and Burkina Faso say dem go collabo to form one joint force to fight jihadist threats for dia kontris.

Niger army chief Moussa Salaou Barmou announce say dem go begin operate as soon as possible, but e no give details on di size of di joint force.

E announce di informate for one televised speech on Wednesday afta tok-tok for di capital Niamey.

Groups wey dey linked to both Islamic State and al-Qaeda don kill thousands of pipo for di region in di past year.

Di military regimes for di three kontris don become very close allies in recent months.

Supporters of di Alliance of Sahel States hold flags to celebrate as Mali, Niger and Burkina Faso comot Ecowas

AFP

Last September, dem form one mutual defence pact wey dey known as di Alliance of Sahel States (AES), as dem withdraw from one international force, G5, wey dey set up to fight Islamists for di region.

Violence for West Africa Sahel region don grow worse in recent years despite military goments promises to deal wit di decade-long conflict wit jihadist groups.

Di three kontris don cut all ties wit France, dia former colonial power, wey for years bin get strong military presence across di Sahel.

Mali leaders bin order one UN peacekeeping mission wey don dey di kontri for ova 10 years to withdraw “witout delay”, dem complete di exit for December.

Di military regimes don strengthen ties wit Russia, wey don move in to fill di void.

Dem also announce say dem go comot di West African economic bloc Ecowas.

Di bloc already bin suspend dem as dem urge di military regimes to ensure a quick return to democratic rule and impose travel and economic sanctions on dem.

Dem lift some of di sanctions for February as Ecowas push for dialogue.

Source