Niger coup: Wagner dey take advantage of instability – Antony Blinken

Antony Blinken

Getty Images

Russia Wagner mercenary group dey “take advantage” of di katakata for Niger, US Secretary of State Antony Blinken tell BBC.

Na military dey rule di kontri afta di removal of President Mohamed Bazoum nearly two weeks ago.

Tori be say di coup leaders don ask for help from Wagner, wey everybody sabi say dey for Mali wey be Niger neighbour.

Oga Blinken say im no tink say na Russia or Wagner ginger di Niger coup.

However US dey worry say e possible for di group to “show imsef” for parts of di Sahel region, im tell BBC Focus on Africa programme

“I tink wetin happun, and wetin dey continue to happun inside Niger, no be Russia or Wagner dey ginger am, but… dem try to take advantage of am.

“Every single place wey dis Wagner group don go na death, destruction and manipulation dey follow,” Blinken tok.

“Insecurity don goup, not down”.

Di believe be say Wagner get thousands of fighters for different kontris including Central African Republic (CAR) and Mali, wia e get beta business interests but also dey make Russia diplomatic and economic relationship solid.

Unconfam tori be say Niger don ask Wagner for assistance as di kontri fit ace military intervention.

E neva clear weda Wagner fighters don enta di kontri but one popular Telegram channel Grey Zone wey get connection to Wagner tok on Monday say, dem don send about 1,500 of im fighters go Africa recently.

E no tok which part of di continent dem send dem go.

Wagner leader, Yevgeny Prigozhin tell di military leaders “call us” for one voice message wey dem upload for Telegram on Tuesday.

“We always dey on di side of good, on di side of justice, and on di side of of who dey fight for dia kontri freedom and for di right of dia pipo,” im tok.

Niger junta appoint new minister

Ali Zeine

AFP

Niger junta leader Gen Abdourahmane Tchiani don name one former finance minister as di kontri new prime minister afta di 26 July coup.

Ali Mahaman Lamine Zeine dey replace Mahamadou Ouhoumoudou, wey dey Europe during di coup.

Oga Zeine, wey dey reported to be in his 50s, bin serve as cabinet director and finance minister from 2001 until di army overthrow di late former President Mamadou Tandja for 2010.

One junta tok-tok pesin announce im appointment for one statement e read on di state-owned television channel Télé Sahel on Monday night.

Oga Zeine bin work for di African Development Bank for Chad, Ivory Coast and Gabon in recent years, according to di privately-owned ActuNiger news website.

Di junta on Monday also appoint Brig Gen Amadou Didilli as head of di kontri High Authority for Peace Consolidation (HACP) and Brig Gen Abou Tague Mahamadou as di inspector general of di army and di national gendarmerie.

Dem name Col Ibro Amadou Bachirou, di private chief of staff of di junta leader and Lt Col Habibou Assoumane as di commander of di presidential guard.

Meanwhile, regional bloc Ecowas go meet on Thursday, 10 August to discuss di next move on Niger as di military junta ignore di August 6 deadline di bloc give dem to restore di ousted President Mohamed Bazoum, wey still dey for dia captivity.

Di US bin send di second command for di State Department go Niger for di middle of di uncertain security situation to meet and discuss wit di military junta.

Victoria Nuland, di acting deputy secretary of state tok say di discussion bin dey ‘difficult and frank’ and di army don refuse to reinstate di democratically elected President, Mohamed Bazoum.

She say di sojas tok say dem no go give up power.

Di US insist say diplomacy na di best way to settle di crisis for Niger.

Meanwhile, delegations from Mali and Burkina Faso military goments don assure Niger military coup leaders of dia full support for one solidarity visit on Monday, to General Abdourahamane Tchiani for Niamey, Nigerien capital.

We still dey update dis tori