Nigeria vs Canada live: Asisat Oshoala ready to lead Super Falcons to victory for Fifa Women World Cup

Falcons go play Canada for dia first match on Friday

BBC

Nigeria women’s national team and dia Canadian counterpart go begin dia 2023 Women’s Fifa World Cup campaign wen dem face each oda for di Melbourne Rectangular Stadium on Friday.

Di tournament don already start after co-host New Zealand record di first win by defeating Norway.

Di Super Falcons wey be 11 times champions of Africa don attend all nine World Cup finals wey don shele before now.

While Canada on di oda hand miss di first tournament for 1991 dem neva miss any of di tournaments wey happun afta.

Di Nigerian team reach semi-final of di 2022 Wafcon wey serve as qualifiers to book dia place for Australia and New Zealand.

Dem dey sit for number 40 for di Fifa World Rankings, na dem be di lowest-ranked side for group wey feature co-hosts Australia, Canada and di Republic of Ireland.

Dis one mean say, Falcons need to be at dia ultimate best to make am to di next stage for only di third time since dem begin attend di world cup.

Nigeria vs Canada Team news

Canada and Nigeria play 2-2 draw when dem face each other last year

BBC
Di Canadian team win dia first two games for di last two World Cups

Randy Waldrum team don gain valuable confidence for dia last three matches, recording victories over Costa Rica, Haiti and New Zealand in di last couple of weeks.

Nigeria previous meeting wit Canada for April 2022 produce 2-2 draw and if Falcons fit get similar result many pipo go certainly regard am as success.

Di Canadian team, head into dis World Cup as reigning Olympic champions afta dem win gold for Tokyo two years ago.

Even though like Nigeria dem dey unable to enjoy success in di World Cup, dia best performance for di tournament happun for 2003 when dem finish in fourth place.

Dia next two world cups after dat end for group stage while for 2015 dem try reach Quarter Final before dem chop elimination.

For di 2019 tournament, dem finish second for di group behind Holland to advance to di last-16 wia dem chop defeat by Sweden.

Canada hope na to kick off di tournament wit a win over Nigeria and wetin go give dem confidence be say dem win dia opening games from di last two World Cups.

Fifa women’s world cup groups 2023

Dis year tournament get eight groups, A- H

Each group get four teams.

Group A

New Zealand

Norway

Philippines

Switzerland

Group B

Australia

Republic of Ireland

Nigeria

Canada

Group C

Spain

Costa Rica

Zambia

Japan

Group D

England

Haiti

Denmark

China

Group E

USA

Vietnam

The Netherlands

Portugal

Group F

France

Jamaica

Brazil

Panama

Group G

Sweden

South Africa

Italy

Argentina

Group H

Germany

Morocco

Columbia

Korea Republic

Women’s world cup schedule

Di group stage wey start July 20 and run for ova a two-week period and den finish on August 3.

Dat stage go see group winners and runners-up qualify for di round of 16, wey go take place from August 5 – 8.

Di quarter-finals, wey go shele for Wellington, Auckland, Brisbane and Sydney, dey scheduled for August 11 -12.

Di first semi-final dem go play am on August 15 for Auckland, di oda semi-final go take place on August 16 for di Accor Stadium in Sydney, wey go then host di final on August 20.

Dem go ply di Third-place play-off di day before di final on August 19 for Brisbane.

World Cup fixtures and schedule

All di times na West African time

July 20

Group A: New Zealand vs Norway (8am)

Group B: Australia vs Republic of Ireland (11am)

July 21

Group B: Nigeria vs Canada (3.30am)

Group A: Philippines vs Switzlerland (6am)

Group C: Spain vs Costa Rica (8.30am)

July 22

Group E: USA vs Vietnam (2am)

Group C: Zambia vs Japan (8am)

Group D: England vs Haiti (10.30am)

Group D: Denmark vs China (1pm)

July 23

Group G: Sweden vs South Africa (6am)

Group E: Netherlands vs Portugal (8.30am)

Group F: France vs Jamaica (11am)

July 24

Group G: Italy vs Argentina (7am)

Group H: Germany vs Morocco (9.30am)

Group F: Brazil vs Panama (12pm)

July 25

Group H: Colombia vs South Korea (3am)

Group A: New Zealand vs Philippines (6.30am)

Group A: Switzerland vs Norway (9am)

July 26

Group C: Japan vs Costa Rica (6am)

Group C: Spain vs Zambia (8.30am)

Group B: Canada vs Republic of Ireland (1pm)

July 27

Group E: USA vs Netherlands (2am)

Group E: Portugal vs Vietnam (8.30am)

Group B: Australia vs Nigeria (11am)

July 28

Group G: Argentina vs South Africa (1am)

Group D: England vs Denmark (9.30am)

Group D: China vs Haiti (12pm)

July 29

Group G: Sweden vs Italy (8.30am)

Group F: France vs Brazil (11am)

Group F: Panama vs Jamaica (1.30pm)

July 30

Group H: South Korea vs Morocco (5.30am)

Group H: Germany vs Colombia (10.30am)

Group A: Norway vs Philippines (8am)

Group A: Switzerland vs New Zealand (8am)

July 31

Group C: Japan vs Spain (8am)

Group C: Costa Rica vs Zambia (8am)

Group B: Republic of Ireland vs Nigeria (11am)

Group B: Canada vs Australia (11am)

August 1

Group E: Vietnam vs Netherlands (8am)

Group E: Portugal vs USA (8am)

Group D: China vs England (12pm)

Group D: Haiti vs Denmark (12pm)

August 2

Group G: Argentina vs Sweden (8am)

Group G: South Africa vs Italy (8am)

Group F: Panama vs France (11am)

Group F: Jamaica vs Brazil (11am)

August 3

Group H: Morocco vs Colombia (11am)

Group H: South Korea vs Germany (11am)

Fifa Women’s World Cup Round of 16

August 5

Group A winner vs Group C runner-up (5am)

Group C winner vs Group A runner-up (8am)

August 6

Group E winner vs Group G runner-up (3am)

Group G winner vs Group E runner-up (10am)

August 7

Group B winner vs Group D runner-up (11.30am)

Group D winner vs Group B runner-up (8.30am)

August 8

Group H winner vs Group F runner-up (9am)

Group F winner vs Group H runner-up (12pm)

Fifa Women’s World Cup Quarter-finals

August 11

QF1: Group A winner/Group C runner-up vs Group E winner/Group G runner-up (2am)

QF2: Group C winner/Group A runner-up vs Group G winner/Group E runner-up (8.30am)

August 12

QF3: Group B winner/Group D runner-up vs Group F winner/Group H runner-up (8am)

QF4: Group D winner/Group B runner-up vs Group H winner/Group F runner-up (11.30am)

Fifa Women’s World Cup Semi-finals

August 15

SF1: Winner of Quarter Final 1 vs Winner of Quarter Final 2 (8am)

August 16

SF2: Winner of Quarter Final 3 vs Winner of Quarter Final 4 (11am)

Fifa Women’s World Cup Third Place Match

August 19

Loser of Semi-final 1 vs Loser of Semi-final 2 (9am)

Fifa Women’s World Cup Final

August 20

Winner of Semi-final 1 vs Winner of Semi-final 2 (11am)