France cruise pass Morocco to enta Fifa Women’s World Cup quarter final

France and Morocco

Getty Images

France put up confident display as dem beat Morocco 4-0 to enta di quarter final stage of do Fifa 2023 Women’s World Cup.

Di match wey happun on Tuesday for di Hindmarsh Stadium see Le Bleus score three goals for di first 25 minutes of di game.

France show say dem don develope relationships within dis tournament, and rhythm in dia play.

Dem show say dem pass dis Morocco side, wey still new for dis level.

Di very impressive France team advance to face co-hosts Australia in di last eight.

Second half

French player Diani score

Getty Images

90+4 mins: FULL-TIME

France 4-0 Morocco

90+1 mins: Late change for injury time for France.

Aissatou Tounkara dey on for France, she dey replace Kadidiatou Diani.

90 mins: Morocco get four more minutes of dia World Cup campaign to enjoy (or na endure?).

89 mins: Morocco waste free kick.

Ouzraoui win free kick for Morocco on di right hand side, just over midway inside di French half.

82 mins: SUBSTITUTIONS

Naomie Feller and Estelle Cascarino don enta for some minutes to replace Eugenie Le Sommer – wey no go get hat-trick – and Eve Perisset.

Dem dey show dia ability

78 mins. Heeh, e for be 5:0

E remain small make Kadidiatou Diani fire di bll enta net.

77 mins: 13,557 na di official attendance. Dis na di highest number of crowd wey show for these finals.

75 mins: Hanane Ait El Haj dey really test her luck.

She fly into anoda latre challenge and di ref don make am clear say any more fit result for red to follow di yellow card she bin receive earlier.

70 mins: GOAL!

France 4-0 Morocco

Eugenie Le Sommer

Le Sommer don score her second goal for di night.

67 mins: France win corner kick.

Di first for di game – but France keeper Pauline Peyraud-Magnin catch am.

65 mins: SUBSTITUTION

France replace Vicki Becho wit Sandie Toletti.

Three changes for Morocco:

Off: Fatima Tagnaout, Elodie Nakkach, Anissa Lahmari

On: Sofia Bouftini, Laurina Fazer, Rosella Ayane

61 mins: Thirty minutes to go

France dey pass di ball around but we no dey see di strength dem show for di first half.

Both sides are dey about to make some changes.

58 mins: YELLOW CARD

Hanane Ait El Haj collect Yellow card because she hit Eugenie Le Sommer for back.

53 mins: France dey for di second gear now. Dem dey reserve dia energy for later endeavours.

Dem dey allow Morocco flex muscle.

46 mins: A good start for Morocco.

45 mins: KICK-OFF

Second half don start.

Morocco kick things off for di second half.

First Half

Di Atlas Lioness of Morocco

Getty Images

HALF-TIME

France 3-0 Morocco

45 mins: Dem don add three more minutes to di end of di first half.

Morocco still dey chase shadows.

40 mins: France dey try to score anoda goal.

39 mins: France no too dey stress themselves now. Dem dey stroke di ball around wit ease, and hold Morocco for arms length. Job done.

34 mins: Morocco captain Ghizlane Chebbak bin smash Eugenie Le Sommer for midfield by. Na clear foul, but ref no give yellow card.

31 mins: For a moment, e be like say Morocco fit get opening, but Wendie Renard. Door scata Ibtissam Jraidi pass.

29 mins: Selma Bacha bin almost score di 4th goal.

28 mins: Morocco team dey panic anytime France enta dia defence. di space between di two sides wide.

23 mins: GOAL!

France 3:0 Morocco

Le Sommer don make am 3-0!

Dat go be Eugenie Le Sommer second goal for dis World Cup finals. Na her 91st for her kontri. Nobody else don score pass her.

20 mins: GOAL!

France 2-0 Morocco

Kenza Dali score di goal.

A brilliant second goal for France!

15 mins: GOAL – France 1-0 Morocco

Kadidiatou Diani score di goal.

Dat go be Diani fourth goal in two games afta di hat-trick against Panama.

France dey up and running and Morocco already don get huge hill in front of dem.

10 mins: E be like say cold dey Adelaide dis night as few players for Morocoo bench use blanket to cover body.

France continue to dey in possession of di ball di most. Dem need correct interception from Sakina Karchaoui to stop make Morocco no collect am.

7 mins: France dey hold di ball for these early stages. Dem dey enta Morocco for midfield to win back di ball if dem lose am.

2mins: Na bright start for France so far.

France 0-0 Morocco

1min: KICK OFF

France vs Morocco head to head

France don lose only one of dia ten games across competitions dis year.

Les Bleus don score 11 goals and concede five in dia last five games.

France dey make dia fifth appearance for di World Cup as opposed to one for Morocco.

Morocco done lose half of dia last ten games across competitions.