Disadvantages of condoms: Mata of condoms wey cause HIV, belle and gonorrhoea for Uganda don turn court case

Condom

Getty Images

Three Ugandans don drag di kontri Drug Authority and international NGO Marie Stoppes ontop accuse say dem dey expose dem to STDs and pregnancy, afta dem use condoms wey no dey work.

One of di men claim say im use di Life Guard condom brand, but it burst during sex, wey come make am catch HIV, while anoda pesin say im begin dey sick because of gonorrhoea wey enta im body.

One woman also say she carri belle afta she use di condoms.

Di NGO supply di condoms wey di drug authority bin later remove from circulation in 2019.

Di three pipo court petition dey claim say di condoms no dey tested for quality before dem release am to public.

NGO Marie Stoppes supply close to two million condoms every month across di kontri.

Condom

Getty Images
Na 30 million condoms dem dey import for Ghana

Di suit dey demand say make goment comot di NGO importation and distribution licence.

Also, dem want make di National Drug Authority, di agency wey dey testing and approve all medical products before e reach market, to take responsibility for how dem fail for dia duty.

For November 2019, di goment bin recall di two batches, wey reach like one million condoms, afta complaints begin enta from di public. But by dat time, many don already by am dey use, and na 70 percent dem recover.

Di two mean bin don sue Marie Stoppes before inside anoda separate case for February dis year. Dem ask for money as compensation.