WAEC: Unity Schools for Nigeria no go do dis year West Africa Examinations Council assessment

Breaking tori foto

BBC

Nigeria goment say Unity schools no go take part in dis year West Africa Examination Council until e dey safe to resume.

Minister of Education Adamu Adamu advise WAEC and state goments to no reopen schools until e dey safe to do so.

Adamu wey tell tori pipo dis one afta di virtual meeting di federal executive council hold also appeal to States wey don announce di resumption of school for dia states to reconsider dia position so as not to endanger di lives of di students, say “e no dey safe to reopen schools now.”

On 30 June, 2020, di presidential taskforce on coronavirus Federal goment give green light for graduating classes for Nigeria to reopen even as dem extend phase two of di lockdown.

Oga of di task force, Boss Mustapha, say classes like Primary six, JSS 3 and SS 3 go open again in order to prepare for dia graduating exams dem.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.