Jennifer Lopez file for divorce from Ben Affleck afta two years of marriage

Image shows Lopez and Affleck

Getty Images
Lopez list di date of dia separation as 26 April inside court documents

Hollywood stars Jennifer Lopez and Ben Affleck dey divorce after two years of marriage.

Lopez file for divorce on Tuesday for di Los Angeles County Superior Court, according to court documents wey BBC see.

Di two – wey tori pipo dey call Bennifer – formally tie di knot for Las Vegas for July 2022 and hold a larger wedding ceremony for Georgia di following month.

Dia romance begin after dem meet while dem dey work on di set of di 2003 crime caper Gigli. Dem bin originally plan to marry dat year, but dem call am off early for 2004.

Almost two decades later dem spark up dia relationship again.

“Love dey beautiful. Love dey kind. And e turn out say love dey patient. Twenty years patient,” Lopez bin tok for 2022 after announcing di Las Vegas wedding.

BBC don contact dia representatives for comment.

One court filing for di case say Lopez or her attorney need to notify Affleck with a copy of her petition to dissolve dia marriage.

Media reports indicate Lopez, wey bin legally change her last name to Affleck, no list any details of a prenuptial agreement for her petition for divorce.

One document filed for LA Superior Court for di case say both Lopez, 55, and Affleck, 52, must share financial information, including dia current income, expenses, properties and debts.

Di document say both dey mandated to reveal any change to dia finances “until final agreement don dey about all financial issues in your case”.

Di court give Lopez 60 days to file a financial disclosure and Affleck go get anoda 60 days after she submit her information to do likewise.

Di filing say if either fail to report or update financial information, e fit result in a court-imposed sanction.

For months, speculation don dey over dia relationship. According to reports, dem bin put dia Beverly Hills mansion up for sale at $65m (£50m) and pictures show dem outside separately without dia wedding rings.

Jennifer Garner and Ben Affleck

Getty Images
Jennifer Garner and Affleck

Jennifer Lopez and Ben Affleck marriages

Affleck, wey be two-time Oscar winner, bin dey married to actress Jennifer Garner before, e bin meet her on di set of 2001 romance Pearl Harbor. Dem part ways 2015 after a decade of marriage and dem get three children together.

Lopez don dey married four times, first to Cuban-born waiter Ojani Noa from 1997-98; den her former back-up dancer Cris Judd from 2001-03; and to singer Marc Anthony, wey she get twins with, from 2004-14.

Di singer and actress, wey dey known as J.Lo, bin also once dey engaged to New York Yankees star Alex Rodriguez.

 Jennifer Lopez and Marc Anthony

Getty Images
Lopez and Marc Anthony

Source